Dennis Idohosa
Hau e go bi
Dennis Idohosa
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Fest nem | Dennis |
| Famili nem | Idahosa |
| Wen dem bon am | 11 August 1980 |
| Ples wey dem bon am | Ovia South-West |
| Fest langwej | Edo langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Edo langwej, Naijá langwej |
| Wok wey e dey du | politician |
| Post wey e dey | member of the House of Representatives of Nigeria, member of the House of Representatives of Nigeria |
| Party wey e dey for politis | All Progressives Congress |
| Candidacy in election | 2023 Nigerian House of Representatives election |
| Rilijon | Christianity |
| Hair kolor | black hair |
| Memba of | 10th National Assembly of Nigeria |
Dennis Idohosa (Dem bon am on 11 August 1980) na Naija politishan wey dey sarf as deputy Govnor of Edo Stet sins 12 November 2024. E don sarf as memba of Haus of representatives fom 2019 rish 2024.
How e stat life and edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Dennis Idohosa on 11 August 1980, insaid Benin City, Edo Stet. E get digre in Sociology an a masta in Legislative Stodies for Canada an Nigeria.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]E don wok wit private kompini ontop health mata bifor e join politis. Na im bi di Edo Stet Ministry Investments, Poblik an Private Partnership (2014-2015) onda Adams Oshiomole administrashon. Na memba of di Nashonal Agency of Great Green Wall, Abuja, fom March 2018 rish November 2018.