Cornelius Adam Igbudu

From Wikipedia
Cornelius Adam Igbudu
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wen dem bon am1914 Chenj-am
Wen e kpai1981 Chenj-am

Cornelius Adam Igbudu (1914-1981) wey dem sabi as Adam Igbudu na di lait founding evanjelis of di Anglikan Adam Prishing Sosaiti (A.A.P.S),[1] one evajelikal grup wey bi part of di Naija Anglikan Church. Isaiah Ogedegbe don kol am "Isoko ogbonge evanjelis".[1] E also don kol am "persin wey kari mirakos for inside im bodi",[1] wey dem sabi as persin wey don heal sick pipul.[2][3]

For 1992, Profesor Michael Y. Nabofa rait one buk abaut im laif and dem dey kol di buk: "Adam: Di Evanjelis".[4] For May 1998, Profesor Sam U. Erivwo bin rait sey Bishop Agori Iwe, wey live dorin im laif taim, bin hold Cornelius Adam Igbudu "in very high regard".[5] For August 2022, Linus Edeigba also rait one buk abaut im laif.[6]

Legasi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Today, dem don trace di orijin of som existing Naija independent churches to di evanjelistik ministri of Cornelius Adam Igbudu for di Naija Anglikan Church, and di nems of di churches na God's Grace Ministri wey D. D. Mimeyeraye dey lead (now dem sabi am as D. D. MiyeriJesu) and Niu Glori Revival Ministri wey S. U. Ayanyen dey lead.[7] To rekonice im evanjelistik achievemet for di Naija Anglikan Church, dem kol Cornelius Adam Igbudu a saint and dem also nem a church afta Igbudu (St. Adam's Anglikan Church for Oghio wey dey for di Olomu aria of Delta Stet). Dem nem one sekondri skul for Araya (Adam Igbudu Memorial Sekondri Skul)[8] afta Igbudu, inkluding one bibol skul for Emevor (Adam Igbudu Kristen Institute).[9]

Di Anglikan Adam Prishing Sosaiti (A.A.P.S) nor end along wit Cornelius Adam Igbudu for 1981. In fact, e don grow ova di years and, akording to Profesor Sam U. Erivwo, through dis mofmet di Urhobo, di Isoko and di Itsekiri bin witness (and still dey witness) ogbonge revival.[10]

Cornelius Adam Igbudu

Akording to Profesor Amos Utuama, e don tey since prishing of Bibol hapun for di Isoko neshon bikos as far bak as 1950, dem bin get one ogbonge Evanjelis wey bi di lait Cornelius Adam Igbudu.[11] Dem tok sey e bin "visit church afta church, win konvats and enkorej bilivas".[12] Dem also tok sey e bin get disagrimet wit one ogbonge Naija Isoko klerik, Akbishop Christian Aggrey Apena, wey e bin akyuz of "disturbing im ministri" for di Naija Anglikan Church.[13] Dem also tok sey e bin "leave betalicious legasi for di Christian race for Isoko".[14]


Dem bon Akbishop Cyril Odutemu for May 2, 1972 for one krusade ground dorin di evanjelikal exploits of di lait popular evanjelis, Cornelius Adam Igbudu.[15] E bin spend 14 months for im mama belle and na di intavenshon of Cornelius Adam Igbudu mek im mama fit push am out for di krusade ground.[16]

Pej wey konsan dis one[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.0 1.1 1.2 Ogedegbe, Isaiah (15 March 2023). "Cornelius Adam Igbudu: Isoko's Greatest Evangelist". Opinion Nigeria. Archived from the original on 15 March 2023. Retrieved 24 May 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. "Igbudu, Cornelius Adam". DACB.org.
  3. "History of the Founder". AAPS.org.ng. Archived from the original on 2023-05-11. Retrieved 2023-05-24.
  4. Nabofa, Michael Y. (1992). Adam: The Evangelist. Daystar Press. ISBN 978-978-122-224-5.
  5. Professor Sam U. Erivwo. "FOREWORD". Urhobo Historical Society.
  6. "Adam Igbudu : He got provoked in the spirit and commanded his dead father to come back to life". Infopedia Publication. 23 August 2022.
  7. Smit, Johannes; Kumar, Pratap (2018). Study of Religion in Southern Africa: Essays in Honour of G.C. Oosthuizen. BRILL. p. 108. ISBN 978-904-740-749-2.
  8. "Foundation Brings Succour To Students In Isokoland, Donates 50,000 Notebooks". BigPen Nigeria. 31 October 2017. Retrieved 25 May 2023.
  9. Agamugoro, Peters (12 February 2022). "Adam Igbudu Christian Institute Graduates 26 Masters Degree Students!". Anglican Diocese of Warri. Retrieved 25 May 2023.
  10. Erivwo, Samuel U. (1979). The Urhobo, the Isoko and the Itsekiri: A History of Christianity in Nigeria. Daystar Press. p. 139. ISBN 978-978-122-139-2.
  11. Ahon, Festus (22 January 2009). "Nigeria: We'll Uphold Sanctity of Christianity -Utuama". AllAfrica. Retrieved 27 May 2023.
  12. Onibere, S. G. A.; Adogbo, Michael P. (2010). Selected Themes in The Study of Religions in Nigeria. African Books Collective. p. 72. ISBN 978-978-842-224-2.
  13. Eyoboka, Sam; Abugoh, Gladys (1 December 2013). "Why I fought Idahosa, Anglicans - Archbishop Christian Aggrey Apena". Vanguard News. Retrieved 29 May 2023.
  14. Odidi, Godday (1 July 2014). "We don't have influential Pastors and Musicians in Isoko-Pastor Odidi". The Nigerian Voice. Archived from the original on 1 June 2023. Retrieved 1 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  15. "Odutemu: 10 Things You Should Know About New Archbishop Of Bendel Province". Niger Delta Today. 11 January 2020. Archived from the original on 10 August 2020. Retrieved 1 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  16. Iyasere, Justice (2 May 2022). "ARCHBISHOP ODUTEMU @50: THE STORY BEHIND THE GLORY". Wado City Reporters. Archived from the original on 1 June 2023. Retrieved 1 June 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)