Cornelia Sorabji

From Wikipedia
Cornelia Sorabji
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromBritish Raj, India Chenj-am
Nem for lokal langwejCornelia Sorabji Chenj-am
Fest nemCornelia Chenj-am
Wen dem bon am15 November 1866 Chenj-am
Ples wey dem bon amNashik Chenj-am
Wen e kpai6 July 1954 Chenj-am
Place of deathLondon Chenj-am
MamaFrancina Sorabji Chenj-am
Broda an sistaSusie Sorabji, Alice Maude Sorabji Pennell Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dubarrister, novelist, folklorist, raita Chenj-am
Post wey e deywomen's rights activist Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Mumbai, Somerville College Chenj-am
Notable workIndia Recalled Chenj-am
Awod wey e koletKaisar-i-Hind Medal, first class Chenj-am

Cornelia Sorabji (Dem bon am for November 15, 1866 an e kpai July 6, 1954) na Indian lorya, soshal riforma an raita. E bi di fest fimeli wey wan pass out from Bombay Yunivasiti an di fest wuman to rid law for Oxford Yunivasiti.Afta wey Sorabji finish Oxford Yunivasiti, e go bak to Indian an put bodi in soshal an advaisa wok to hep di Purdahnashins. Purdahnashins na wuman-dem wey dey no grie mek dem du enitin wit man wey no dey dia kontrie.Sorabji no fit go kot go fight for dose wuman bikos e Neva get di professional standin or satifiket to du am.Bikos of di one, Sorabji go du e LLB ezaminashon in Bombay Yunivasiti in 1987 an "Pleader ezaminashon of Allahabad Hi Kot in 1899.Sorabji kom bikom di fest fimeli wey dey spik for kot.Na 1923 dey chenj di law for Indian so dat wuman sef go fit bi Barrista for Kot an na day year e kom bi Barrista. Sorabji put bodi for meni soshal savis kampain grups. Som of di grup na Nashional Kaunsu for Wumen in Indian, di Fedirashon of Yunivasiti Wumen, an di Bengal Ligi of Soshal Savis.Sorabji no sopot sey mek dey komposiri how Westa pipul dey si tins for di chenj abaut wuman-dem in India.E dey kiyefu as e dey du e best to chenj soshal mata an e no sopot fast fast chenj hadiya. Sorabji biliv sey onti evri wuman no buk, all di politikal chenj wey dey wan du no go eva last. Sorabji sopot di British Raj, an Purdah for Hopa-Kast Hindu Wumen an e no sopot Indian Self-Rule Bikos of wetin e biliv, e no get di sopot wey e nid to rili chenj som soshal mata. Sorabji put mouth for meni poblikashon wey hep mata in di earli 20 senturi.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]