Jump to content

Chude Jideonwo

From Wikipedia

Chude Jideonwo (dey bon am 16 March 1985) na Naija pesin wey dey tok for T.V, e na fim-meka, an na pesin wey sabi yuz intanet do bizness. Jideonwo join bodi tek form Red Africa and Joy, Inc, wey bi one Amerika organizeshon wey get ofis for Naija. E don wok for midiya ofis, ofis wey dey havatais.

Na Jideonwo bi pesin wey dey tok inside #WithChude tok show. E still bi di manija wey dey mek suo sey di show #WithChude dey hapun so dat pipo fit dey enjoin am. #WithChude na one program wey dey ask pipo kweshon to no di koko of mata wey dey hapun. Jideonwo still bi di pesin wey dey daret on program kol #ChudeExplains. #ChudeExplains na one program wey dey tok mata wey no go well for di envaromet an mata about kolsho. Jideonwo also dey among pipo wey form The Future Project. Dis The Future Project don help kampain for two Naija presidet an one One presidet wey de Ghana.

For November 2023, Dey pik Jideonwo to bi di presidor of TIERs. (The Initiative for Equal Rights).

How im tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Legos Stet dey bon Jideonwo on 16 May 1985). E papa nem na Ifeanyi S. Jideonwo an e mama nem na Ngozi A. Jideonwo. Jideonwo go K. kotun Memoriha Pamari skul, Adebola Baptist High Skul, an Mayflower School, Ikenne. Jideonwo leta kom go Yunivasiti of Legos to rid Law. For November 2007, Jideonwo get di haprova to go kot dey defend pesin for dia.

E go do e Masta for Pan-Afrika Yunivasiti, wey dey Legos. Na midiha an komunikeshon e rid for e Masta digri

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for NTA Jideonwo start im wokin. Im dey tok for di TV steshon.E leta komot go dey do risach wok for Celebrating Jesus (MBI) an Inside Out with Agatha. Inside Out with Agatha na one show wey dem dey show for di hol kontri an na dia Jideonwo mit Adebola Willians. Both of dem kom leta join bodi to form Red Africa. Jideonwo bi di pesin wey dey arenj how one program kol New Dawn go dey go for NTA Netwok. E don hapiya an show on di Academy, Patito's Gang, Video 10, Big Broda Naija, MNet, Moments with Mo'm , Rubbin' Minds tok show on Channels Televishon.