Jump to content

Charles Soludo

From Wikipedia
Charles Soludo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemCharles Chenj-am
Wen dem bon am28 July 1960 Chenj-am
Ples wey dem bon amAguata Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dueconomist, banker, politician Chenj-am
Post wey e deyGovernor of the Central Bank of Nigeria, Governor of Anambra State Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Nigeria Chenj-am
Hair kolorblack hair Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Charles Chukwuma Soludo CFR (dem bon am on 28 July 1960) na Naija politishan, banka, an ekonomist wey sarf as di fifth govnor of Anambra Stet sins March 2022. Na forma Govnor an chairman of di board of diarekto of di Centra Bank of Nigeria. Na on di 29 May 2004, dem apoint am as bank govnor, e dey insaid President Muhammadu Buhari Presidenshal Ekonomik Advisory Committee.

Im pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Charles Chukwuma Soludo insaid di famili of Pa Simeon Soludo. Im mama kpai insaid Naija civil war wey e dey eight years old. E gro insaid Isuofia Vilej in Aguata, Anambra Stet. E go Uga Boys High Skul, wia e tek sarf as Sinior Prefect. E stil go Universiti of Nigeria Nsukka (UNN) in Enugu Stet, wia e tek get im fest Klass honors in Ekonomiks in 1984. In 1987, e kolet master's for di sem Universiti in 1987 an doctorate in 1989, e finish as best students for hol du three levels. E kon bi profesor of Ekonomiks insaid UNN.

Soludo mari Nonye Frances Soludo sins December 1992, an dembon six pikin.