Buruji Kashamu

From Wikipedia
Buruji Kashamu
pesin
Part ofNigerian senators of the 8th National Assembly Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am19 May 1958 Chenj-am
Ples wey dem bon amOgun Chenj-am
Wen e kpai8 August 2020 Chenj-am
Place of deathLagos Chenj-am
Manner of deathnatural causes Chenj-am
Cause of deathCOVID-19 Chenj-am
Place of burialOgun State Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am
Post wey e deymember of the Senate of Nigeria Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am

Buruji Kashamu na (dem bon am on 19 May 1958 an e kpai on 8 August 2020) na forma Naija politishan wey sarf as senator for Ogun East insaid di 8th Nashonal Assembly. Ogun East kova eleven lokal govmet arias: Ijebu North East, Ijebu North, Ijebu Ode, Ijebu East, Ikenne, Odogbolu, Remo North, Sagamu, an Ogun Waterside. Senator Kashamu na vais chairman of di senate committee on States an Lokal Govmet. Na ogbonge pesin insaid People's Democratic Party (PDP), PDP Ogun State. Na im bi di chairman, an Mobilizashon Committee of PDP wey dey South West Zone of Nigeria. In 2018 dem komot am for People's Democratic Party, dey leta Kansu am wen dem go Abuja High Kourt in October 2018. Na im bi di 2019 kandidate for People's Democratic Party in Ogun State. Na COVID - 19 time e kpai wey hapun for Naija in August 2020.

Hau e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Kashamu in Ijebu - Igbo Ogun State, Nigeria on 19 May 1958. Kashamu stat im edukashon for Ansarudeen Primary School, Ijebu Igbo an e komot dia in 1872 to go St. John Primary School, Lagos. E kon go evening klas for Igbobi College. Wen e dey wok as agent. E leta go London wia e len Business Management for Pitman college, London . Dem giv am honorary PhD for Cambridge Graduate University, wey dey Massachusetts.

Politis[chenj-am | chenj-am for orijin]

E go for Ogun East senatorial posishon an e win pesin wey folo am, Prince Dapo Abiodun of di All Progressive Congress. Kashamu get 99,540 vote an Prince Dapo Abiodun wey bi sekond get 84,001 votes. Na im stil bi di pesin wey kom out for PDP for Ogun State gubernatorial eleshon but e lus to Dapo Abiodun of di ALL Progressives Congress na im kom 4th.

=Katakata wey hapun[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1998, dey kach Kashamu for United Kingdom bikos of drug Mata web e trai enta Di kontri wit $230,000. Dey leta rilis am in 2003. British no gree Kari di kase kom Naija.

Hau e tek kpai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na COVID - 19 Kashamu virus kil am for Lagos on 8 August 2020, wen di virus dey Naija. Na 62 years old e bi wen e kpai.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1PDP Expels Buruji Kashamu, three others. Punch Retrived 5 August 2023.