Bruno Mars

From Wikipedia
Bruno Mars
pesin
Part ofSilk Sonic Chenj-am
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromAmerika Chenj-am
Nem for lokal langwejPeter Gene Hernandez Chenj-am
Orijina nemPeter Gene Hernandez Bayot (Bruno Mars (Nombre artistico)) Chenj-am
Fest nemPeter, Gene Chenj-am
Famili nemHernandez Chenj-am
AliasBruno Mars Chenj-am
Nik-nemBruno Mars Chenj-am
Wen dem bon am8 October 1985 Chenj-am
Ples wey dem bon amHonolulu Chenj-am
PapaPeter Hernandez Chenj-am
MamaBernadette San Pedro Bayot Chenj-am
Broda an sistaEric Hernandez, Jaime Kailani, Tiara Hernandez, Tahiti Hernandez, Presley Hernandez Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokSpanish, English langwej Chenj-am
Wie e go skulPresident Theodore Roosevelt High School Chenj-am
Wie e dey livHollywood Hills Chenj-am
Wen e stat wok2004 Chenj-am
E pipulStateside Puerto Ricans, Filipino Americans Chenj-am
Partner in business or sportAnderson .Paak Chenj-am
Voice typetenor Chenj-am
DiscographyBruno Mars discography Chenj-am
Named afterBruno Sammartino Chenj-am
Memba ofThe Smeezingtons Chenj-am
Record labelAtlantic Records, Motown, Universal Motown Records, Elektra Chenj-am
Influenced byMichael Jackson Chenj-am
Awod wey e koletAmerican Music Award for Artist of the Year, QQ Music Awards, Grammy Award for Song of the Year Chenj-am
Official websitehttps://www.brunomars.com/ Chenj-am
Copyright representativePRS for Music Chenj-am

Peter Gene Hernandez (dem bon am October 8 , 1985), dem sabi am for im wok as Bruno Mars, na American singa, song raita, an rekod produsa. Dem no am wit im stai for stage, an hau e dey du difren musik like pop, R&B, funk, soul, reggae, disco, an rock. Mars dey pafom wit im band, di Hooligans, wey sabi pley difren kain of song wit elektrik guitar, bass, piano, keyboards, drums, an horns, an dem dey hep Mars dans an sing ontop stage.

Na for Honolulu, Hawaii dem bon am, Mars kon go Los Angeles in 2003 to stat to dey sing. In 2009, e dey insaid pipu wey stat The Smeezingtons, wey hep Mars du beta song wey mek pipu sabi am. Plenti pipu sabi am insaid 2010 wit di song "Nothing on You" wey B.o.b sing an "Billionaire" wey Travia McCoy, wey e sing insaid di two songs, dat sem year Bruno Mars rilis studio album Doo-Wops & Hooligans, wey get pop wit reggae an R&B. Songs wey enta numbs one dey insaid im fest album "Just the way You Are", "Grenade, an "The Lazy songs". Wit di wey e Sabi sing disco, funk, rock, reggae, im sekond album Unorthodox Jukebox (2011) get hol di kain stai e sabi, an na im fest nomba one song for Billboard 200. E stil get two Billboard Hot 100 numba one songs, "Locked Out of Heaven" an "When I was Your Man".

In 2014 Mars dey insaid Mark Ronson's "Uptown Funk", wey top plenti musik chart, e stey fourteen an seven weeks ontop Billboard Hot 100 an di UK single chats. Mars third studio album, di R&B 24 e Magic (2016), kolet seven Grammy awods, e win Album of the Year, Rekod of di Year, an Song of di Year. Di album get som top singles "24 Magic", "That's What I Like", an "Finesse" remix wey e du wit Cardi B. In 2021 Mars an Anderson. Paak, as Silik Sonic, rilis album wey dem gada di togeda An Evening with Silk Sony. Di song get four Grammy Awods.

Mars don sell ova 130 million rekods for hol di wod, wey mek am pesin wey dey sel pas insaid pipu wey dey sing. Eight of im songs don rich nomba one on Billboard Hot 100 an im sho dey insaid sho wey kom pas. E don kolet 15 Grammy Awods, four Brit Awods, eleven Amerika Music Awods, 13 Soul Train Awods an e get three Guiness Wod rekods. E don sho for Music week best song raitas (2011) an Billboard Greatest of all Time Artist. (2019). Na Mars bi di fest Artist to kolet six Diamond-certified songs in di United States.

Im life an wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

1985- 2003: Hau e tek stat life an im musik wok.

Peter Gene Hernandez wey dem bon on October 8, 1985, in Honolulu, Hawaii, to Peter Hernandez an Bernadette San Pedro Bayot. Im papa na haf Jewish an haf Puerto Rican orijin, wey kom fom Brooklyn, New York. Mars don tok am bifor sey im fore fada na fom Hungary an Ukraine. Im mama muv fom Phillipines to Hawaii, an dem fit trac am Fillipino an Spain. Im mama an papa meet diasef wen dem dey du sho wia im mama dey danc Hula an im papa dey pley. Na sinc wen e dey two years old dem don dey kol am "Bruno" an na bikos e luk lik one pesin wey dey fight wrestle "Bruno Sammartino".

Mars na one pikin insaid di six pikin wey dia papa an mama bon, na hol of dem lik difren kain of songs. Dia mama na Sabi danc an sing, im papa pafom Little Richard's misik, wey dey insaid wetin mek Bruno lik to dey sing. Im Uncle lik to dey du lik Elvis Presley, an e dey tel Bruno wey dey three years to dey pafom song of Elvis Presley an Micheal Jackson. Wen e dey four years old dem dey du sho five days a week wit im famili band, "The Love Notes", an plenti pipu kon sabi am for Hawaii bikos e dey du lik Elvis Presley. Wen e dey five years old e pis for bodi wen e dey pafom Elvis Presley "Can't Help falling in love" (1961), wey mek im papa an mama dey tink weda e fit du misik, but Bruno no stop to dey sing. In 1990 Bruno dey insaid Hawaiian paper Midweek as "Little Elvis" an pafom for 1990 Aloha Bowl.

In 1992, e dey insaid Hooneymoon in Las Vegas fim an Pauley Shore of MTV ask am question on am. Wen Mars dey six years old, e dey insaid The Assensio Hall Show wen e dey smol, e pafom wit di famili band, two shos for one night, e dey hep Frankie Lymon an Little Anthony. Wen im smol, e get smol drum set, guitar, paino, an stil len hau to pley som Oda tins wey Dem dey tek pley songs. When Bruno dey 12 years old im papa an mama no dey togeda, wey mek "The Love Notes" end. Im papa biznes stop. Na bikos of dat one mek dem no kon dey ci Moni lik bifor. E kon komot for im papa an mama haus wit im broda fada. Dey kon dey sta for one smol plez for Hawaii, for bak of car, on top roof, wia dem dey kip animal, Paradise Park, wey bi wia im papa dey wok bifor e stop. Dem chenj Mars skul bikos dem no dey du am wel for dia, but leta dem sabi am wel for di skul.

Hol di time Mars dey kopi Presley, hep am wel for im wok. E leta dey len guitar afta e ci hau Jimi Hendrix dey uze am. In 2020, e gree sey na im famili hep am for musik, e tok sey wetin mek am who e bi na im famili for Hawaii, sey im dey du plenti sho wit im papa for band's. E stil tok sey na evribodi for im famili sabi sing. Evrione sabi pley one tin wey dem dey uze sing. Wen e go President Theodore Roosevelt High School in Honolulu e sing wit one grup wey bi The School Boys, wey dem du plenti shos an dey open im papa niu band. Dey pafom songs wey the Isley Brothers an di Temptation du. Di singa wen e dey high skul, Dem sabi am wel wel, na im dey stat som big sho an e dey du kopi Micheal Jackson, Dem dey giv am $75 for one sho.

Na afta im sista wey dey sat for Los Angeles pley im demo for Mike Lynn(wey bi di oga for A&R at Dr. Dre's Aftermath Entertainment rekods), Lynn kol Mars kom Los Angeles. In 2003, wey e jus komot for skul, Mars go Los Angeles bikos of im musik wok. E sta for Mansfield Avenue dat time. E sta wit di nem im papa giv am for smol Bruno, but e put "Mars" join am bikos: E tok sey plenti girls dey ask am for pizza an e no dey get am, nd dat one mek dem tink sey e no dey dis wod, sey im kon tink sey na fom Mars e kom fom. Anoda tin wey mek am get niu nem na bikos e no wan to dey difren, dat time dem dey ci am as anoda Latin singa. Dey trai mek am sing Spanish song sef.

2004-2010: Prodoshon wok an It's Better If You Don't Understand

Afta e go Los Angeles, Mars sign rekod kontrat wit Motown rekods in 2004, but di rekod no go wel, wey mek am folo Will.i.am management tok, wey no stil go wel sef. Afta Mars rekod deal no go wel, e no komot for Los Angeles an e leta get anoda kontrat wit Amerika rekod produsa Steve Lindsey an Cameron Strang at Waterside Independent in 2005.

Lindsey sho Mars an im frend wey dey rait song Brody Brown an Jeff Bhasker (wey Mars sabi wen e dey wit Mike Lynn) hep Mars sabi hau to rait pop music an dey difren fom odas. Lindsey tok sey: tek am five years to tich Bruno abaut som oda ogbonge artist wey pipu like dia songs.