Bobrisky

From Wikipedia
Bobrisky
pesin
Man abi wumantrans woman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1991 Chenj-am
Ples wey dem bon amLagos Chenj-am
Fest langwejYoruba Langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Yoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey duentrepreneur Chenj-am
Wie e go skulUniversity of Lagos, King's College, Lagos Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
Personal pronounL485, L484 Chenj-am

Okuneye Idris Olarewaju (dem bon am on 31 August 1991), wey plenti pipu sabi as Bobrisky, na Naija pesin wey mek imsef bi wuman an na pat of LGBTQ pipu. Dem sabi am wel for soshial media apps Snapchat, TikTok an Instagram. Plenti pipu sabi am for TikTok, afta e stat to dey du as "bobrisky" insaid 2021.

Hau e tek stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am as Okuneye Idris Olarewaju in 1991, Bobrisky go King's High School, Lagos an Okota High School, Lagos for im sekondri skul Edukashon, kon go stodi akountin fom University of Lagos (UNILAG), Nigeria.

Hau e tek opun eye[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem sabi am bikos of hau e tek dey liv life for Soshial media wey difren fom hau oda Naija pipu dey. Plenti pipu dey folo am for Instagram du. Plenti pipu dey folo am for soshial media. Som sabi am as e tok sey e dey mari anoda man lik am for wey Naija lor no apruv. On 8 July 2021, Shi sho pipu sey e don go du surgery wey mek am bi lik wuman.

Mata wit EFCC[chenj-am | chenj-am for orijin]

Economik n Financial Crime Commission (EFCC) charj Bobrisky to kourt bikos of dey way e tek dey du Naira note for Parti.

Hau pipu tek tok for im mata[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem don giv Bobrisky plenti chans for event mek e tok to pipu wey dey dia. One pesin wey dey wok for president, Bashir Ahmad, waka komot as e ci sey Bobrisky dey wia im dey. Insaid 2019, Otunba Olusegun Runsewe, wey bi Direkto General of Nigeria's Nashonal Councils for Art an kolsho, kol Bobrisky disgras to Naija pipu an sey pipu go du am enihau if dey ci am for road.

Hau e tek afet oda pipu[chenj-am | chenj-am for orijin]

Taiwo Kola Ogunlade, Google's komunikashon an poblik Mata Manager for West Afrika, tok sey na Bobrisky dem find pas for Naija fom October rish November 2016. Bobrisky stil bi frend wit beta ogbonge aktres an aktor lik Tonto Dikeh