Bob Manuel Udokwu

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Bob Manuel Obidimma Udokwu (dem bon am for April 18, 1968) na Naijá akto, dareto, produsa an politishian. For 2014, e kolet di laiftaim Akademi Awards. Dem selet am for best sopotin Aktor for 2013 Nollywood movies Awards for di rol for Adesuwa.

How e tek stat laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bob Manuel Udokwu kom fom Nkwelle Ogidi, Idemmili North LGA of Anambra Stet for Naijá.E bi ful Igbo pesin. Di nem of im papa na Geoffrey Nwafor Udokwu an im mama nem na Ezelagbo Udokwu. Dem bon am for Enugu state. Na im bi nomba four pikin for di famili of six pikin dem. Na Bob bi di sekond man pikin.E kom fom famili wey get 3 man pikin an 3 wuman pikin dem.

How e get go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bob go St. Peter Primary School (nau Hilsaid Primary School) for di coal camp Enugu, Enugu Stet for elemintari Edukashon an Oraukwu Gramma skul, Oraukwu Anambra state for im sekondri edukashon.E kom go University of Port Harcourt, Port Harcourt Rivas Stet wia e kolet im Bachelor's of Arts degree in Theatre of Arts. Bob get Masters degree for Political Science wit speshializashon in intanashonal Rilashon frum di University of Lagos, Legos Stey

Fo di year 1989 - 1990, Na bob bi di presido of Naijá univasiti of tiata akt student Assosiashon.

Tori abaut im laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for University of Lagos Udokwu tek see im waif Cassandra Joseph wen e dey du e Masta digri.Dat taim Cassandra Joseph na ondagraduate for di Univasiti. Dem mari for February 19, 2000.Dem bon two pikin, one gel an one boi pikin.Dia nem na Elyon Chinaza(gel) an Marcus Garvey(boi) Bob nem di boi pikin Garvey Udokwu afta di politika lida Marcus Garvey.

Fims wey e akt insaid[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Living in Bondage
  • Rattlesnake
  • Karishika
  • The Key for Happiness
  • Black Maria
  • What a World
  • Heaven after Hell
  • A Time to Love
  • Cover Up
  • Endless Tears
  • Naked Sin
  • My Time
  • Home Apart
  • Games Men Play
  • Soul Engagement
  • Living in Bondage: Breaking Free