Betta Edu

From Wikipedia
Dr. Betta Chimaobim Edu
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemBetta Chenj-am
Famili nemEdu Chenj-am
Wen dem bon am27 October 1986 Chenj-am
Ples wey dem bon amCross River State Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey duphysician, politician Chenj-am
Post wey e deyminister Chenj-am
Wie e go skulFederal Government Girls College, Calabar, London School of Hygiene & Tropical Medicine, Texila American University, University of Calabar Chenj-am
Party wey e dey for politisAll Progressives Congress Chenj-am

Betta Chimaobim Edu (dem bon am on 27 October 1986) na Naija politishan. Wey dem komot as Minista of Humanitarian Affairs an Poverty Alleviation afta e folo for 585 million Naira ($640,000; £500,000) mago-mago mata. Shi sarf as wuman nashonal leader of All progressive Congress. Na shi bi Cross River Stet Commissioner for Health bifor shi resign insaid 2022. Na shi bi bifor bifor Nashonal Chairman of di Nigeria Health Commissioner Forum.

Hau shi stat life an skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Betta for Lagos|Legos, Nigeria to di famili of Mr Emmanuel Eke. Dat taim, im mama na pesin wey dey wok wel for hauz an im papa na biznes man.

Shi finish sekondri skul in 2001 for di Federal Government Girls College, Calabar an shi get digre in medicine an surgery fom Di Universiti of Calabar in 2009. Shi get Post graduate diploma in Public Health for kontri wey jus dey kom up fom London School Hygiene & Tropical Medicine, an Doktor of Public Health fom Texila American University.

Im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2015, na Edu bi di pesin wey smol pas wey Govnor of Rivers Stet, Benedit Ayade giv posishon of Community an Primari Health Care.

In 2020, na shi bi di chairman of Cross River Stet COVID-19 Taskforce. For August dat year, na shi bi di nashonal chairman of di Nigeria Health Commissioners Forum.

Edu na memba of di Royal School of Public Health an African Institute of Public Health Professionals. Na Betta bi di pesin wey smol pas wey go bi nashonal wuman leader of All Progressive Congress (APC) insaid March 2022.

Awords[chenj-am | chenj-am for orijin]

Nigeria Quintessential Woman Award, Federal Ministry of Women Affairs and Social Development (2020)

Award of Excellence, National Youth Council of Nigeria (2020)

Medical Expert of the Year (2020)

Award of excellence in Gender inclusion, Federal Ministry of Women Affairs (2023)

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Betta Edu emerges youngest APC national woman leader. Punch Newspapers. 27 March 2022. Retrieved 4 December 2023.


2. Dr Betta Edu emerges as the National Chairman of Nigeria Commissioner for Health Forum. Vanguard Nigeria. 1 August 2020. Retrieved 18 September 2023.