Jump to content

Ayinla Omowura

From Wikipedia
Ayinla Omowura
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1933 Chenj-am
Ples wey dem bon amItoko Chenj-am
Wen e kpai1980 Chenj-am
Manner of deathunnatural death Chenj-am
Cause of deathcerebral hemorrhage Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokYoruba Langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dumusician Chenj-am
Wen e stat wok1970 Chenj-am
E pipulYoruba pipul Chenj-am
RilijonIslam Chenj-am
Stai of song abi fimfuji music Chenj-am

Waidi Ayinla Yusuf Gbogbolowo wey dey stil sabi as Ayinla Omowura (1933 - 6 May 1980) na bifor bifor Naija Apala singa wey dem bon for Itoko, Abeokuta in 1933.

Tori abaut im life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omowura na Yusuff Gbogbolowo, wey bi blaksmit, an Wuramitu Morenike pikin. E no tu go skul wey mek am dey du im papa wok iron wok but e leta go du som oda wok lik; driva, sel meat, kapenta an bus park boi.

Plenti pipu no Aruna bikos of di kain wahala wey dey hapun wit am an oda musikshan like; Haruna Ishola, Ayinde Barrister, Fatai Olowonye, Yesufu Olatunji an Dauda Epo Akara.

Omowura no tu go skul but e sabi wetin dey hapun for di kontri dat taim an e sabi uze koret wod for im musik. E dey uze im songs let pipu no abaut wetin govmet dey do an wetin dem won du. Insaid I'm 1976 album, Owo Udoji, e tel govmet dey dem du wel as dey kari workas moni go up an tel dem mek du di sem tin for workas wey dey for private kompinis.

Som of im wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

E du 22 LP rekod wey EMI Rekods rilis (wey bi Ivory Records Nigeria nau), dem rilis 2 afta e don kpai. 1972 – National Population Census

1972 – Challenge Cup ’72

1973 – Orin Owo Ile Eko (Lagos Rent Edict)

1973 – Challenge Cup '73

1974 – Challenge Cup ’74

1976 – Owo Udoji

Owo Tuntun

How e tek kpai

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omowura kpai insaid bar faight wey hapun on May 6, 1980 wen e dey 47 years. Na Bayewu, wey bi im manaja knack am kop dem dey uze drink for head. Dem kari Bayewu go kourt an dey jorj sey mek dem kpai am tu. Di day e kpai EMI Rekods sel 50,000 kopis of one one of im album.

How dem uze sabi am

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omowura wok wel wel wen e dey sing Apala. Di kain wey e wok mek Apala muzik popula wel wel. Niu singa lik Terry Akpla, Qdot Alagbe an Mayolee kopi dem for some dia songs.

Ibikunle Amosun, forma govnor of Ogun Stet go du Omowura's Itoko, Abeokuta wel for im 40 years anniversary day wey e kpai.

Tunde Kilani, wey bi Diarekto an produsa, an e kom fom Abeokuta tu du fim for Ayinla Omowura e kol di fim Ayinla ,e rilis am on June 18 2021.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]