Amanda Villepastour

From Wikipedia
Amanda Villepastour
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Orijina nemAmanda Vincent Chenj-am
Fest nemAmanda Chenj-am
Wen dem bon am20 January 1958 Chenj-am
Ples wey dem bon amPerth Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej Chenj-am
Pat of wok wey e put mindmusicology, ethnomusicology, Q14806044, Yoruba pipul Chenj-am
Wu e dey wok forCardiff University Chenj-am
Wie e go skulSchool of Oriental and African Studies, University of London Chenj-am
Work locationSubdivisions of Wales Chenj-am

Amanda Villepastour (dem bon am for 20January 1958) na one Ostrelia pesin wey stodi difren-difren Kolsho muzik an shi bi bifor-bifor Profeshona muzishan. Pipul know am wel-wel say na shi dey play keyboard for one grup of muzishan for Ostrelia wey dem dey kolEurogliders araund 1980-1987 Meni pipul sef know am bikos shi try wel-wel for di risash wok wey shi do an di buk wey shi poblish ontop Yoruba Muzik for Naija an Afro-Cuban rilijon Muzik dem for Kuba(Cuba)

Hau Shi Liv E Laif an go Skul wen Shi stil bi Smol-pikin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon for Perth for western side of Ostrelia.Shi go Methodist Ladies Kolej wey dey Nia di siti of Claremont. For di bigin of 1970 dem, wen shi stil bi 14 yia old,Shi stat to dey play muzik wel-wel as a Profeshona. Bitwin 1974 am 1976, na shi dey play piano,accorfion,an stil dey sopot di pesin wey dey sing for one grup wey dey sing wey dem kol Duck Soup. For one intaviu wey Afropop Worlwide Tori pesin do wit an wey dem poblish for 2016,shi tok say Duck Soup bi like Chicago Blues Muzik grup for Perth. Villepastour bi student wey stil dey for skul from 1977-1980 for di Dipatment of Muzik for Yunifasiti of Western Ostrelia. Shi join-bodi wok wit Roger Smalley wey bi Anhlo-Australian pesin wey dey rait song ,dey play piano an wey dey kondort Muzik wen pipul dey sing.Shi even stil play Javanese Gamelanmuzik wit Bernard Ijzeediaat(Suryabrata),wey Jaap Kunst train an e sef kom train one Amerika pesin wey dem kol Mantle Hood wey stodi difren-difren pipul muzik (ethnomusicologist) an Pipul bilif sey na e bi pesin wey stat gamelanfor United States. Villepastour graduet as pesin wey dey konpos song wit Bashelor of Muzik.

Hau Shi go Skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eurogliders For 1980 Villepastour an one muzishan from Perth wey e nem bi Bernie Lynch kom join-hand tek form one Muzik grup, an dem kol am Livong Single Dem agri sey na Villepastour go dey play keyboard an Lynch go dey rait song an dey play giita an ho stil dey song. Di two of dem kom find oda pipul wey go join dia grup.Dem yuz Crispin Akerman as anoda pesin wey go dey play giita,Don Meharry go dey play Bass an Guy Slingerland to dey play drum dem.