Alex Ibru

From Wikipedia
Alex Ibru
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Fest nemAlex Chenj-am
Wen dem bon am1 March 1945 Chenj-am
Wen e kpai20 November 2011 Chenj-am
Pesin wey e mariMaiden Alex Ibru Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Naijá langwej Chenj-am
Wok wey e dey dubusinessperson Chenj-am
Wie e go skulNottingham Trent University Chenj-am

Alex Ibru (1 March 1945 – 20 November 2011) na one time Naija biznesman, pésin wey é stat an dey publish The Guardian newspaper plus Minister of Internal Affairs from 1993 go rish 1995 for di time wey General Sani Abacha wey be soja dey contlo di kontry.

Background[chenj-am | chenj-am for orijin]

Alex Ibru bi di son of Chief Janet Omotogor Ibru and brother of Chief Michael Ibru, wey bi di chairman of the Ibru Organization. Dem born Ibru for 1 March 1945 for Agbhara-Otor, inside Delta State. Him attend di Yaba Methodist Primary School (1951–1957), Ibadan Grammar School (1958–1960), Igbobi College, Lagos (1960–1963) and Trent Polytechnic for United Kingdom (1967–1970), where him bin read Business Economics.

Business career[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ibru be di former chairman of Rutam Motors. For 1983, him bin join hands with newspapermen Stanley Mecebuh of Daily Times of Nigeria, Dele Cole also formerly of that paper and Segun Osoba, wey bin dey Nigerian Herald come start The Guardian in 1983 with 55% of the money coming from the Ibru family, wey Alex Ibru come be chairman.

The Guardian get many acada people on top him board, wey dey take style support Obafemi Awolowo's Unity Party of Nigeria, and the first editor Lade Bonuola bin get strong support the UPN. For the other hand, Ibru bin come from a millionaire business family and Stanley Macebuh bin dey right wing in his views, so the paper try make dem balance things. As the paper bin promise to provide him readers news wey no get bias come keep to their promise,na him make The Guardian come dey successful and popular. Na this popularity make dem follow with the introduction of news magazines such as Newswatch. Di military regime wey dey dat time no too like the kind independence wey dat paper get,na him make dem begin trouble dem under military ruler General Muhammadu Buhari (January 1984 – August 1985).

Ibru carry money take sponsor Civil Liberties Organization (CLO),wey dem establish for the military regime of General Ibrahim Babangida. Dem appoint Ibru as Minister of Internal Affairs from 1993 to 1995 for inside the Sani Abacha government. Na this appointment by Abacha wey everybodi bin see as style to take beg the press.

Ibru don tell his staff inside The Guardian say him no go ever join politics but apart from this, the man bin dey criticise the Abacha regime. For 14 August 1994,the government raid and shut down the office of the The Guardian offices although dem no comot Alex Ibru for his post. Dem no allow the newspapers to open until October 1994 after Ibru don apologise for any bad comment wey dem don make for inside the newspaper against government.

Alex Ibru kpai for 20 November 2011, for 66 yies.