Akure

From Wikipedia

Akure na city wey dey for southwestern Naija an im bi di kapital siti. Na im big pas for Ondo stet. E get pipul wey rish like 484,798 for 2006 population census.

History[chenj-am | chenj-am for orijin]

De city na di trade senta for farming where dem dey grow foods like cocoa, yams, kasava, korn and tobako.dem dey grow grains like rice, beans, millet wey be the major sources of carbohydrates.

Geography[chenj-am | chenj-am for orijin]

E bi like 700 km southwest of Abuja an 311 km north of Lagos State. Di town dey for tropical rainforest zone of Naijá.

Religion[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akure get various religions. Pipul wey dey live there dey pratis kristen, Islam an traditional religion. Churches plenti for di siti and di sentral mosque on di Oba Adesida Road na mejor for di city. Akure dey very pisful.