Ado Ahmad Gidan Dabino

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search
Ado Ahmad Gidan Dabino
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Famili nemAhmad Chenj-am
Wen dem bon am1964, 1 January 1964 Chenj-am
Ples wey dem bon amKano state Chenj-am
Fest langwejHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokHausa langwej Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokHausa langwej Chenj-am
Wok wey e dey duraita, film director, film producer Chenj-am
Wie e go skulBayero University Kano Chenj-am
RilijonMuslim Chenj-am
Awod wey e koletaward for best leading actor, Merit Awards, honorary award Chenj-am
Described at URLhttps://gistrends.com.ng/ado-ahmad-gidan-dabino/ Chenj-am
Personal pronounL485 Chenj-am

Ado Ahmad Gidan Dabino (MON) na Hausa langwej raita, buk meka, poblisha, Niuz ripota, fim produsa, dareto an aktor. E rait difren buk on top difren tins for abaut 30 years. E don poblish 15 buk. On September 29 2014, foma Presido Goodluck Ebele Jonathan gif am awod as The Member of the Order of the Niger (MON) to honor am.

Tori abaut e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Gidan Dabino for 1964 for Danbagina of Dawakin Kudu Lokal Govament aria of Kano Stet.Gidan Dabobo stat dis informashion edukashion fom e papa. E kom go Zangon Barebari go lens Quran. E get diploma in Mass Communication fom Bayero University Kano.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gidan Dabino di CEO of Gidan Dabino international Nigeria Ltd, na one big maketin konsota fam mey don dey sins 1990.E bi assistant editor/distribushion manija of Zamani one Hausa Magazine in 1997.Gidan Dabino bi di editor and poblisha of Mumtaz Magazine in 2000.In 2004 im bi Editor -in-Chief of Hantsi Magazine onda di Kano Chief Bureau Community.Di Niuzpepa wey dey hep pipul to rid an rait in nativ langwej. Fom 2012 kom rish now, na e bí di Contributin Editor of Muryar Arewa, na evri month Magazine of di Northern Communication and Media Service LTD.

Novel wey im poblish[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • In Da So Da Kauna 1&2, Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1991.[1] ISBN 978-309283-9 and ISBN 978214900-4
  • Hattara Dai Masoya 1 & 2, Published by Gidan Dabino Publishers ISBN 978-309285-5
  • Masoyan Zamani  1& 2, Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1993 ISBN 978-214901-2 and ISBN 978-214902-0
  • The Soul of My Heart (Translation of in Da so Da Kauna), Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1993 ISBN 978-214903-9
  • Wani Hani Ga Allah 1 & 2, Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1994 ISBN 978-214906-3 and ISBN 978-214907-1
  • Nemesis (Translation of Masoyan Zamani), Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1995 ISBN 978-214905-5
  • Kaico!, Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1996 ISBN 978-214933-0
  • Duniya Sai Sannu, Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 1997
  • Malam Zalimu, (A Hausa play and winner 1st prize prestigious award of 2009 Engineer Mohammed Bashir Karaye Prize in Hausa Literature), Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises,  Kano. 2009
  • Dakika Talatin Published by Gidan Dabino Publishers Enterprises, Kano. 2015 ISBN 978-808215-7

Fim wok wey e du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gidan Dabino na one of di pipul wey stat Hausa fim indostrie in Northern Naija wey bi Kannywood.E don rait, produs an daret meni Hausa fim.Na e bi di main karata in Da So da Kauna (1995), fim wey dem du fom di novel wey e rait. Gidan Dabino las fim Juyin Sarauta na e kolet awox pass for Hausa Movie of the year 2017 and 2018. E akt as Sarki Yusufa of Jadarwa. Im win two aword of di best aktor and one nomination.

Awod[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di following are among di awards received by Gidan Dabino:

  • Best Actor in Leading Role:Amma Award Season 5, 2018 Nominee,
  • Best African Actor:Zuma Film Festival, 2017.
  • Member of di Order of di Niger (MON)

Dis awod na bikos e hep to contribute to di kontrie.

  • 2014 Award of Honour in recognition of efforts and outstanding contributions toward uplifting Hausa Literature.
  • 2013 Engineer Mohammed Bashir Karaye Prize in Hausa Literature (Play Category) 2009.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. "Tsohuwar Taska: Littafin 'In Da So Da Kauna' — Leadership Hausa Newspapers". leadershipayau.com. Archived from the original on 28 November 2018. Retrieved 1 October 2018.