Zangbeto

From Wikipedia

Zangbeto na one juju way di pipu of Ogu or Egun for Benin, Togo and Nigeria tok sey e dey luk dem for night. Dem stil dey kol am polis an sekuriti. Na wetin dem tek dey yuz to let pipu obey di law an to mek sur sey everibodi dey sef an sekuriti dey for di komuniti. Dem dey fear dis zangbeto wel-wel and na polis way no bi govment polis way dey protekt di pipu for naite and dey proteckt their propati and dey cash pipu wey do bad-bad tin and bring dem for di komuniti to ponish.

Hau e bi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Baze on aw di wok wey i dey do to dey protekt di pipu of Ogu sosayiti, for gun langwej, zangbeto min "men wey get naite" or "man-dem wey dey wok for night".

E get as dem dey uze smol-smol liv and som part of palm tree dem way dem don color. somtimes es sef dem fit jost bi like say dem no dey where dem dey egen. Som pipu biliv sey if dis one hapun like dis, e mean sey spirit don enta their bodi I get pawa to kontrol di way pipu dey do tins. But di Ogu pipu biliv sey no bi pesin dey their but na spirit wey dey kontrol night.

For dem Ogu komuniti, dem biliv sey na Zangbeto bi di sekuriti or polis for their kominity-dem. Dem even get som sikrit groop way bi say na onli di pipu we dey serve di juju fit join. Zangbeto get som kind pawa-dem, like to swalo glas and no bi sey i wan uze am do bad tin but i wan uze am porshu winch-dem. If e don bi like say e no know where im dey egen, dem say zangbeto fit kontrol some kind pawa wey don dey dis world bifor humanbin-dem kom and e de give sense to di Ogu pipu and mek di ogu pipu kontinu to de dis life.

Dem de do plenti big-big zangbeto pati for plenti-plenti Ogu komuniti-dem for inside West Africa. Di one way pipu sabi pas na di one way dem dey do for Porto-Novo for Benin Republic and for Ajido for Legos for Naija. Na plenti-plenti tins dem dey do for dis pati-dem we dey swit wel-wel and dem dey do majik sef.