Yuza:Jemmabond

From Wikipedia

How una dey? My name na Ellen Ekanem. I be writer, teacher, and civil servant wey dey live for UK. I been live for Port Harcourt when I be small pikin, na 'im make I sabi broken; na Boma Erekosuma teach me. Na PH Broken I dey use, but you fit see other elements sha.

When I dey write for Pidgin, I dey use original spelling so everybody fit read am. Me, I hate am when person forge spelling sotay, you no sabi wetin you dey read again (Na "Country" or "Kontri"?) Even for Wikipedia self, I no know say "Main Pej" na "Main Page". Maybe na because I been speak with London accent before-before.

Anyway sha, na try I dey try. Make una no vex. Peace.