Yul Edochie

From Wikipedia
Yul_Edochie_Portrait

Yul Chibuike Edochie (dem bon am for January 7, 1982) na Naijá akto wey dem nem am afta one popula Russian akto Yul Brynner. E kom fom Anambra Stet in Naijá.Yul Edochie papa na Pete Edochie. E gro up for Legos an Enugu. Na Yul Edochie bi di last bon of 6 pikin wey e papa bon. E marri wen e bi 22 yies.Yul Edochie go Univasiti of Port Harcourt, wie e get Bachelor of Arts in Dramatic Arts.

How e tek stat laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yul Edochie go Lillians' Day Nursery School an Robinson Street Primary School, Enugu. E du sekondari skul for Marist Brothers' Juniorate, Uturu, University Secondary Skul Enugu, Ecumenical Community Secondary Skul Enugu an New Haven Boys Secondary Skul Enugu.

Im pasona laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yul Edochie waif nem na May Aligwe an dem get 3 bois an 1 gel togeda. Dem bi Kambilichukwu Leo Edochie,[1][2] Dani Edochie, Karl Edochie and Victory Zane Chukwubuike Edochie.


For 30 March 2023, tori bi say Kambi, Yul Edochie fest son, don kpai due to a seizure.[3] For di day wey folow Isaiah Ogedegbe ves wit Prophet Samuel King for im komplit lack of simpati for di Edochie famili wen e kom out to tok say e bin predict Kambi death bifor e hapun.[1][2]

Acodin to BBC, Yul Edochie don ripot Kambi death to di Legos Stet Polis Komand, wey don stat investigeshon into di mata.[4]

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yul Edochie stat to akt for Nollywood for 2005 an e fest fim na "The Exquires" wit Late Justus Esiri and Enebeli Elebuwa. Di fim wey mek am popula na "Win of Glory" wey im akt for 2007 wit Genevieve Nnaji an Desmond Elliot.

Yul Edochie Academy[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2015, Yul Edochie opun fim akademi for Legos. E stat di akademi to tish pipu wey won join aktin bizness how to akt an behave demsef. Na Yul Edochie imsef go yuz im hand tish for di Akademi. Di akademi go giv pipu wey sabi akt wel shans to join Naijá Fim Indostri.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.0 1.1 Ogedegbe, Isaiah (31 March 2023). "Kambilichukwu Leo Edochie's Death: A Time When Prophet Samuel King Uses Tragedy To Trend Again -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Archived from the original on 31 March 2023. Retrieved 1 April 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 "Kambilichukwu Leo Edochie's Death: A Time When Prophet Samuel King Uses Tragedy To Trend Again -By Isaiah Ogedegbe". THISDAY. 31 March 2023. Archived from the original on 1 April 2023. Retrieved 2 April 2023.
  3. Sulaimon, Adekunle (30 March 2023). "Yul Edochie loses 16-year-old son". PUNCH. Archived from the original on 30 March 2023. Retrieved 1 April 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  4. "Police say investigation into di death of Yul Edochie son don start". BBC News Pidgin. 31 March 2023. Archived from the original on 2 April 2023. Retrieved 2 April 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)