Yuki kajiura
Yuki Kajiura ( dey bon am August 6, 1965) na Japan wuman wey bi muzik komposa an muzik produsa. Kajiura don mek meni muzik for meni babi film-dem an some of dem bi: Sword Art online, Puella Magi Madoka Magica, Fate/Zero, The Garden of Sinners, an Pandora Hearts. As pesin wey sabi mek muzik, Kajiura way of mekin muzik dey difren to oda pipul bikos e sabi join nowadaz muzik wit eletronik muzik.
How e tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for Tokyo Japan dey bon Yuri Kajiura on August 6, 1965. Muzik don bi pat of Kajiura life sins 1972 as e dey folo go dey play di piano. Di wok wey Kajiura papa dey du mek dia famili pak go West Germany. Wen Kajiura bi seven years old, e rait e fest song wey di tahitu bi:"Thank you, Good-bye". Kajiura rait di song for e gra-mama to tel am gud-bye as Kajiura dey folo e famili komot for Japan.
Kajiura kom bak to Japan wen e de araund 12 to 13 years an dat time e de junior sekondri skul. Kajiura leta finish kolej in Japan. E wok as komputa Disahina onti 1992 bifor e stop di wok to faze mekin of muzik. In 2002, one Japan muzik band kol See-Saw wok wit anoda Mashimo projet kol hack//Sign. Dorin di prodoshon of di projet, Kajiura mit Emily Bindiger. Emily Bandiger luv Kajiura voice wen e sing sotey e tok sey na Kajiura go pafom ova 10 of di song wey de projet. Kajiura even tok wit play play sey na Emily Bindiger bi e Inglish tisha for one show wey bi Anime Expo in 2003.
One of di muzik projet wey Kajiura mek na FictionJunction. For "FictionJunction", e wok wit oda aktist like Yuuka Nanri, Asuka Kato, an Maori Oda. Di one wey Kajiura du wit Yuuka wey e kol FictionJunction Yuuka popular past. In 2004, di two of dem, produs an arenj song for Kōichi Mashimo's Madlax. In 2005, dey du dia fest albom togeda wey dey give di nem: "Destination". Dey tok sey Yuri Kajiura go bi spesha guest for di pafomans of di Eminence Orchestra show in October 2007. Di nem of dat show na: "A Night in Fantasia 2007- Symphonic Anime Edition"