Yewande Adekoya

From Wikipedia

Yewande Adekoya(dem bon am for 20 January 1983),na Naija wuman wey dey akt fim, make fim, do fim and dey produce fim.

How e take stat life and go School[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey born Yewande for Lagos but e papa come from Ososa-Ijebu wey dey Ogun State for Naija. Yewande go Bright star nurseri and primari school, bifo e come go Bright star Comprehensive High School for e secondary skool. Yewande go Babcock University and collect one certificate wey be Bachelor of Arts (B.A) for mass communication. Yewande don marri and e don born many pikin.


How shi stat ha Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Yewande Adekoya stat aktin for 2002 with Alphabash Music And Theatre Group. Shi writ and produs her fest fim in 2006 wey i nem bi “Life Secret”. Shi don produs, direkt and feature inside meni meni Naijá fims such as Omo Elemosho, a 2012 film wey feature Bimbo Oshin, Muyiwa Ademola and Yomi Fash-Lanso. Di fim wey collect 5 nominations at di 10th Africa Movie Academy Awards. Dem still nominate ha for "best new aktress" in di Yoruba category at 2014 City People Entertainment Awards. For di same year, ha rol for Kudi Klepto got ha best actress in a leadin rol nomination at 2014 Best of Nollywood Awards.In December 2014, Adekoya wein di "most promising akt" award at Yoruba Movie Academy Awards.