Yemi Cardoso

From Wikipedia
Yemi Cardoso
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Wie e go skulAston University Chenj-am

Olayemi Micheal Cardoso "Yemi" Cardoso na Naija banka, Chartered stockbroka an poblik polici meka wey dey sarf as di Govnor of Central Bank of Nigeria. E don sarf as bifor bifor Citibank chairman. Na im bi di bifor bifor Commisiona for Legos Stet Ministri of Ekonomi Planin an Budget. On 15 September 2023, Bola Tinubu selet Yemi Cardoso to sarf as di Govnor of Central Bank of Nigeria, for 5 years ontil dem Naija senate komfam am. On 23 September 2023, dem komfam Cardoso as di Govnor of di central Bank of Nigeria.

Hau e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Cardoso go stodi managerial an administrative studies for Aston Univasiti, wia e tek kolet Bachelor of Science (B.sc.) digre. E get Masta digre fom di Harvard Kennedy skul in poblik administration.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Cardoso na bifor bifor chairman of Citibank of Nigeria. E don sarf as board memba of MRS oil an chairman for EFinA. Cardoso na memba of di advisory teem for Lagos Biznes Skul an chairman of di board of African Venture Alliance. Cardoso na bifor bifor commisiona for ekonomic planin an budget for Legos Stet. Na im bi di co-chair of Ehingbeti Summit, Di Legos Stet ekonomic summit. E don sarf as forma exekutiv for Havard Kennedy Skul alumni association.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. "Meet Yemi Cardoso, newly appointed CBN governor". Punch Newspaper , 15 September 2023. 2."PYO's declaration". The Nation Newspaper, 16 April 2022.