Wuzzie George

From Wikipedia

Wuzzie George (1888-Decembee20,1984)na one Paiute wuman wey dey do Kraft wok from North,an shi wok wel-wel to mek dia tradishonal laif an netiv kostom dem get levul wel-wel. Shi stil join-bodi tek wok wit Margaret Wheat wok ontop di wok wey shi rekod for Northern Paiute Lifeways

Wen E Dey for Smol Pikin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wuzzie Dick George for circa 1880-1883 an dem dey kol am Wizi,"Smol Anima" an di nem kom ton to Wuzzie for Inglish. Shi bi di girl-pikin of Sam an Suzie Dick, of di "Cattail-Eater" wey bi old netiv grup, shi bi memba of di Northern Paiute train for West of Nevada.Bifor-Bifor,Paiute pipul dey do Waka abaut an dem no dey stay for one ples for long time, an dem bon for dem bon am for di time wey pipul juz dey gada smol-smol tins for Stillwater Mountain Range, bot shi spend Meni of e Laif hifor wia dem dey lol Fallon an Stillwater, Nevada. Wen shi stil bi smol girl,e grand papa an mama,Stovepipe an Mattie tish am Meni of di netiv kostom an tradishonal stori dem wey shi kom wok wel-wel to mek am get beta levul. Afta e papa an mama sepret wen shi stil bi 10 yia old pikin,wuzzie stat to dey wok wit di White Ernst famili an kom stat to dey learn Inglish. Shi even go di Indian Skul Nia Carson Siti bot wen Measles diziz kom stat to Kash pipul,e papa kom komot am from skul. Wen shi stil dey young,shi Mari Jimmy George,dem bon Eight(8) pikin bot na onli five(5) of dem grow. Di two of dem dey togeda ontil di hosband kpai for 1969.

Hau Dem Keep Lifeways[chenj-am | chenj-am for orijin]

George stat to dey tish di tradishonal Lifeways an e yuz an to dey mek di Kolsho get levul. Shi even dey yuz smol-smol drama to tek tish e pipul dem abaut dia tradishon for difren-difren Skul dem. Na shi dey intaprit for for for e hosband wen e dey do tradishonal Shamanic medisin for a for abaut 40 yias ontil midul of 1950 dem. For ova 30 yias, sho dey dey wok to rekod netiv tins wey dem dey do, so dat di tins dem go kontiniu to dey dey. Shi join-bodi wok wit Margaret Wheat,wey dey stodi di orijin of human Sosaiti an Kolsho.Di wey shi do show wel-wel for one buk wey dem kol "Survival Arts of the Primitive Paiutes" an wit Catherine S.Fowleran Sven Liljblad an di two of dem bi pipulwey dey stodi human orijin, Sosaiti an Kolsho. George travul wit Wheat go do one prisenteshon an smol drama(demonstration)