World Tales

From Wikipedia

World Tales wey get di taitu "The Extraordinary Coincidence of Stories Told in all Times, in All Places" na one buk wey get 65 tradishonal tori wey Idris Shah gada araund di wold. Som tori inside di buk de popula an oda tori inside di buk no too dey popula

Wetin dey inside di buk[chenj-am | chenj-am for orijin]

Bifor you rid each tori inside di buk, di pesin wey rait di buk go fest rait smol tin abaut wetin chenj wen dem dey rait am. Di pesin wey rait am go stil tok smol abaut how difren difren komuniti am dey tok di tori di way dem no di tori.

Meni pipo like di buk no bi smol. For ezampul, P.K Page wey dey rait puem wey kom from Canada tok sey na dis kind buk e go like give pikin. Anoda pesin wey dey rait tori an dey rait buk tok sey na "World Tales" mek am like tradishonal tori an get love for tori. Even sey Shah wey gada di tori of di buk tok abaut how di old vashon an di new vashon tek difren, e no too add e own vashon to di tori wey de di buk.

How dem tek poblish di buk[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Harcourt Brace Jovanovich fest poblish di buk for large format. Harcourt do am with piksho. In di fest ples, Shah wey bi di raita of di buk fest tel Ivan Tyrell to add piksho for di tori wey Arthur Rackham, Kay Nielsen, an Edmund Dulac wey dey inside di buk. But Tyrell tel am sey mek e no add di piksho to di buk but mek e rait anoda buk an put di piksho for dat one. Wetin Tyrrell tok swit William Jovanovich wey wan poblish di buk an e gree. Na 37 hatist join paint piksho for "World Tales". No orijina kopi of di buk de again.

Ezampul of tori wey de di buk[chenj-am | chenj-am for orijin]