Witch bottle

From Wikipedia

Witch boltus na one majikal boltus wey pipo bilif sey e fit helep dem fight against witch pipo. Meni histri tori wey dem gada from England an United State tok abaut am. Di fest time wey pipo confab sey dem menshon "witch boltus" na from 17th -senturi in England

How di tin tek start an di risin for am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipo don sabi "Witch boltus" sins 1681. One buk wey Joseph Glanvill rait in 1681 wey bi "Evidence concerning Witches and Apparitions tok abaut am.

How di tin luk like[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di rekod buk wey de show sey na from solt "stoneware jug dey mek witch boltus . Ezampul of witch boltus na Bartmann jugs, Bellarmines. Somtimes, dey fit kol di Bartmann jugs "Greybeards". Di nem Bellarmine kom from Robert Bellarmine. Im na one katolik pesin wey like to dey kweshon protesta pipo enihow an e join hand wen dem dey yuz faya bon Giordano Bruno ontil e kpai. Afta somtimes, pipo kom dey yuz gilas boltus an odas kontena mek witch boltus

Wetin dey de inside di witch boltus[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na beta witch wey no dey yuz e own witch do bad bad tins go arenj wetin go de inside di boltus. Di beta witch go kolet di pesin wey bilif sey bad witch dey wahala am pisss (urine), e finga nail, e hair an one red rope. Leta, di beta witch go kom join am with rosimari , nidu an pin. E go stil put red wine join am.