Wise old man

From Wikipedia
A wise old man: Philosopher in Meditation by Rembrandt

Di wise old man na di ezampul or patan wey dem dey yuz tok or rait tori wey popula wel. Carl Jung bi one of di pesin wey tok abaut dis tin wel wel. Di wise old man in a tori fit bi pesin wey pipo fit kwik-kwik no wen pesin dey rid tori-buk bikos e get beta sens inside di tori.

How pesin fit no am inside tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di wise old man inside tori fit bi pesin wey don old an get beta sens inside di tori. E dey yuz e nolej wey e don get abaut pipo an di wold helep tok abaut di life histri of pipo so dat dey go fit no di orijin of wia dem kom from. E dey do like mentor for pipo. Somtimes, di wise old man fit kom from oda kolsho, neshon or fit bi time wey don pass bifor bifor. E fit no bi norma pesin just like di tori of Merlin wey e bi half human bein.

For luv tori an tori wey pipo dey imajin, di wise old man fit bi majishan. Somtime, e fit bi pesin wey jos dey on e own wey no dey folo pipo waka or tok. For some tori, di wise old man fit bi di pesin wey dey tek pipo wey wan go luk for one impotant tin inside forest how dat tin impotant rish an di tori wey folo di tin wey dey wan for find.

Inside some tori, pipo fit no see di wise old man for some time so dat di mejo pesin of di tori go fit show wel wel so dat pipo go no-am.

How dey yuz di wise old man for rilijion tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

For Kristen rilijion, pipo konsida Abraham, Moses, Solomon, Methuselah, Joseph, an Hapostul Paul wey dey inside Bible as di wise old man. For New Testament an Old Testament wey dey inside Bible, di mejo tin wey e dey tok abaut histri of pipo wey don gro old na: If pesin gro old na God blessin bi dat. Pipo wey gro old an kpai rili enjoin life. For buk wey Moses rait inside Bible, e tok sey pesin wey lisin an respet e papa an mama an wey no do magomago go gro old an enjoin e life.

Wetin pipo no abaut old age for oyinbo kontri kom from di nolej wey dem get as dem dey rid di bible. Bible tok sey pesin wey don old dey get sens, dip nolej an experiens. Bible stil tok sey wen pipo don dey old, luv no dey shak dem again, dia bodi no dey strong like bifor an meni of dia habiliti like to smel somtins no dey wok norma again