Williams Uchemba

From Wikipedia

Williams Uchemba (dem bon am for October 22 1989) im na Naija akto an fim produsa, pipu no am for di rols wey i pla for sugar Rush, Merry men an No string Attached.

Hau Im Tek Stet Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Uchemba as wi tok bifo dem bon am for October 22 1989. I kom frum Abia State an stet to dey akt muvi as pikin. I get im fest livin satifikati for Abia stet, im kom dicidi to go studi intanashonal rilashon for univaciti of Naija Nsukka. Oscar Brunella na wifi of di akto Williams uchemba.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Williams Uchemba stet aktin elli 2000. I stet im karia as child aktor for di fim di Journey of di dead. I lata go akt for one fim wey di nem na Oh my son for 2002 an i pla di rol of pikin for di fim.

Fims Wey Im Akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • 2001 : The Journey of the dead
  • 2002 : Oh My Son
  • 2002 : Dorothy My Love
  • 2018 : Merry Men
  • 2020 : Sugar Rush