Wikipedia:Kraiteria for spidi dilishon

From Wikipedia

Templet:Redirect Templet:Redirect

Templet:Nutshell Templet:Dilishon polici list

Di kraiteria for spidi dilishon (CSD) dey specifai di onli kaysis wey administraetors get brod konsensus to bypass dilishon diskoshon, for dia diskreshon, and immediaetli dilit Wikipedia pej or media. Bikos dilishon only dey revasibul onli by administraetors, oda dilishons dey okor onli afta diskoshon, unless dem bi proposd dilishon. Spidi dilishon dey intended to rediuz taim waestaij on dilishon diskoshons for pej or media wit no pratikal chans to sovaiv diskoshon.(For dis kontex, spidi dey rifa to di simpul decishon-mekin proces, no bi di lehnt of taim sins di fes edit of, or on, di atikul). Enibodi fit reques for spidi dilishon by addin wan of di spidi dilishon templer, but onli administraetors, stewards or sysops fit aktuali dilit eni atikul.

Bifor you nominaet eni pej for spidi dilishon, konsida wheda di atikul fit dey impruvd, rediuz to a stub, mej wit anoda atikul or dey redairected elswhe, revat to a beta previous revishon, or dey handuld for som oda wei (si Wikipedia:Dilishon polici § Altanetiv to dilishon). A pej dey elijibul for spidi dilishon onli if aul of e histri also dey elijibul. Yuzas wey dey nominaet pej for spidi dilishon need specifai which kraiterion/kraiteria di pej fol into, and nid notifai di kriaetor of di pej and eni maejor kontributor. If a pej dey needed to bi remuvd from Wikipedia for praivaci reasons (e.g. non-publik pesinal infomeshon, a pikin dey revil hau old dem dey, posibul libel), request ovasaiht insted.

Templet:Ankor For mos spidi dilishon kraiteria, onli editor wey is no bi di pesin wey mek di pej fit remuv di tag. Pesin wey mek pej wey no agree wit di spidi dilishon need to insted klik on di Kontes dis spidi dilishon botin wey dey apia insyd of di spidi dilishon tag. Dis botin dey link to the diskoshon pej with a pre-fomated erea for di pesin wey mek di pej to explaen why do pej soppos dey Wikipedia. If anoda editor oda than di pesin wey mek di pej remuv a spidi dilishon tag in gud faet, tek am as a sain say di dilishon dey kontrovashal and mek dilishon proces dey yuzd. Di pesin wey mek a pej fit remuv di spidi dilishon tag onli if di kraiterion in question bi G6, G7, G8, G13, G14, C1 or U1.

Administraetors tek kia mek una no spidi dilit pej or media except for di mos obvious kayses. If a prj don sovaiv e mos recent dilishon diskoshon, no need for am to dey spidi dilited except for kopiraiht vaiolaeshons wey recentli dey diskovad and pej-dem wey meet specifik unkontrovashal kraiteria; diz kraiteria dey noted bilou. Kontributors somtaims dey mek pej ova several edit, so administraetors need avoid dilishon of pej wey seem inkomplit too soon afta dem jos mek am.

Besyds spidi dilishon, di folouin metods of dilishon dey:

Letta-nomba abrevieshons (G12, A3...) often dey yuzd to rifa to diz kraiteria, and dey givin for each sekshon. For exampul, "CSD G12" dey rifa to kraiterion 12 wey bi for general (kopiraiht infrinjment) and "CSD U1" dey rifa to kraiterion 1 unda yuza (yuza request). Som nomba wey dey in-bitwin dey usuali dey skipd, as abrevieshons wey dey implai obsolet kraiteria stil dey unyuzd. Diz abrevieshons fit konfiuz niu editors or enibodi els wey no dey familia wit dis pej; for plenti situeshons a plaen-Inglish explanaeshon of why a specifik pej dey or soppos dey dilited dey moh preferabul.

Requestin for spidi dilishon[chenj-am for orijin]

Immediaetli afta each kraiterion belou bi a list of templet wey pesin fit yuz to mark pej or media files for spidi dilishon unda di kraiterion wey dey in yuz. In orda to alat administraetors, stewards or sysops to di nomineshon, plaes di relevant spidi dilishon templet for on top of di pej or media file you dey nominaet (but si Templet:Sectionlink belou). Abeg dey sure to suplai a edit sumari wey dey menshon say di pej dey nominaeted for spidi dilishon. Aul of di spidi dilishon templet get dia nem as Db-X wit Db for 'dilit bikos'. A list of di Db-X templet dey Wikipedia:Kraiteria for spidi dilishon/Dilishon templet.

If a pej fol unda moh than wan of di kraiteria, insted of addin multipul tag e dey posibul to add a singul {{Db-multipul}} tag to kova aul of dem. For exampul, if an atikul seem to bi both blatantli promoshonal (G11) and also fael to indikaet signifikans of e subjet (A7) then di tag {{Db-multipul|G11|A7}} fit dey yuzed to indikaet both of diz koncerns. Then di atikul fit dey spidi dilited if an administraetor, steward or sysops don assess am and decyd say eida or both of di kraiteria applai.

From di Inglish Wikipedia, strong konsensus say di pesin wey mek pej and maejor kontributors to di pej or media files need to dey warnd of di spidi dilishon nomineshon (or of di dilishon). Aul spidi dilisjon templet (wey dey yuz kraiteria oda than U1, G5, G6, G7, and G8) thus kontaen for dia bodi a pre-fomatted, sojested warnin templet to notify di relevant pati or patis abaut di nominaeshon for spidi dilishon unda di kraiterion wey dey in yuz. You fit kopi and paest such warnin to di tok pej of di pesin wey mek di pej and di maejor kontributors, choos from odas wey dey listed at Category:CSD warnin templet, or plaes di unifaid warnin templet, Templet:Tlxs, wey dey alau you to tailor your warnin unda eni patikula kraiterion by replecin csd wit di asosheted kraiterion abreveshon (e.g. g4, a7).

Yuz kommon sens wen you dey applai a spidi dilishon request to a pej: reviu di pej histri to mek sure say aul elia revishons of di pej meet di speedy dilishon kraiterion, bikos a singul editor fit replaes an atikul wit material wey fit to kos di pej to meet wan or moh of di kraiteria.

Pej-dem wey need to dey tagd for a speshal manner[chenj-am for orijin]

Som pej eida no fit or no soppos dey tagd for spidi dilishon for di normal manner:

  • Pej wey you no fit edit (e.g., diu to proteshon), or JSON pej: plaes di templet for di korrespondin Tok pej insted, along wit an explanaeshon of which pej to dilit.
  • Templet: pej: plaes di templet widin a noinklud tag, laik dis: <noinklud>...</noinklud>
  • Modul: pej (except for /dok pej): plaes di templet wit Module:Modul wikitext, laik dis: require('Module:Module wikitext')._addText('{{Db-x}}')
  • CSS (inklud sanitaizd CSS) or JavaSkript pej: plaes di templet for a komment, laik dis: /* {{Db-x}} */

Pej wey don sovaiv dilishon diskoshon[chenj-am for orijin]

As an excepshon to di norm say a pej sovaiv e mos recent dilishon diskoshon mean say e no soppos dey spidili dilited, di folouin kraiteria applai also to douz pej, wit or witaut eni specifaid limiteshons:

Templet:Unbulleted list

Deez kraiteria onli fit dey in yuz for soch kays wen no kontrovasi dey exist; in di event of a dispeut, start a niu dilishon diskoshon. Haueva, niuli diskovad kopiraiht vaioleshons soppos dey tagd for G12 if di vaioleshon alreadi dey exist for aul previous revishons of di atikul. G5 fit also dey yuzd at diskreshon, subjet to meetin di kraiterion wey dey autlynd abov.

Templet:Shortcut Deez dey applai to evri typ of pej wit list of exklushons for specifik kraiteria, and so applai to atikuls, drafts, redairekts, yuza pej, tok pej, files, etc. Read di specifiks for each kraiterion to si whe and hau dem dey applai.

G1. Patent nonsens[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Templet:Maen Dis dey applai to pej wey konsis entaiali of inkoherent text or gibberish wit no meaninful kontent or histri. E no kova poor raitin, patisan skreeds, obsceen remarks, implausibul theoris, vandalisim, hoax, fikshonal material, koherent non-Naijá material, or poorli translaeted material. In shot, if e dey undastandabul, G1 no applai. E also no applai to pej-dem for di yuza nemspaes.

G2. Test pej[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Dis dey applai to pej wey dey exist to test editin or oda Wikipedia fonkshons. E dey applai to subpej of di Wikipedia Sandbox wey pesin or robot fit mek as tests, but no dey applai to di Sandbox isef, pej for di yuza nemspaes, or valid but unyuzd or duplikaet templet.

G3. Pior vandalisim and blatant hoax[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Templet:Further Dis dey applai to pej wey bi blatant and obvious misinfomeshon, blatant hoax (inkludin files wit intenshon to misinfom), and redairekts wey exist by kleanup from pej-muv vandalisim. Atikuls abaut notebul hoax dey acceptabul if e dey klear say na hoax dem dey deskraib for insyd.

G4. Rimekin of a pej wey dey dilited per a dilishon diskoshon[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Dis dey applai to suffishentli identikal kopi, wey get eni taitul, of a pej wey dey dilited via e mos recent dilishon diskoshon. E no inklud pej wey no dey substanshali identikal to di dilited vashon, and pej to which di reason di dilishon no longa dey applai. E no inklud pej for di yuzaspaes and draftspaes whe di kontent dey konvated to a draft for explicit impruvment (but no bi simpli to cirkumvent Wikipedia dilishon polici). Dis kraiterion also no kova kontent wey dey undilited via a dilishon reviu, or wey onli dey dilited via proposd dilishon (inkludin dilishon diskoshons wey dey klosd as "soft dilit") or spidi dilishon.

G5. Krieshons by bannd or bloukd yuza[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Templet:Further Dis dey applai to pej wey bannd or bloukd yuza mek in vaioleshon of dia ban or blouk, and weyget substanshal edits by odas.

  • To qualify, di edit or pej must bi pej wey dem mek while di yuza aktuali dey bannd or bloukd. A pej wey dem mek bifor di ban or blouk dey imposd or afta di ban or blouk dey lifted no go qualify unda dis kraiterion.
  • For topik-bannd editors, di pej must bi a vaioleshon of di yuza specifik ban, and must not inklud kontribushons lejitimaetli abaut som oda topik.
  • Wen a bloukd or bannd pesin yuz an altanaet akaunt (sokpoppet) to avoid a restrikshon, eni pej wey di sok akaunt mek afta di elies blouk or ban of eni of dat pesin akaunts qualify for G5 (if odas no substanshali edit am); dis na di mos kommon kays for applaiyin G5.
  • G5 no need to dey applaid to transkluded templet or populaeted kategoris unless dem dey transkluded or populaeted entaiali by di bannd or blouked yuza; deez edits need to dey reverted bifor dilishon.
  • {{Db-g5|nem of bannd yuza}}, {{Db-bannd|nem of bannd yuza}}
  • Katigori:Kandidaets for spidi dilishon as havin been maed by bloukd or bannd yuza

G6. Teknikal dilishons[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Templet:See also

Dis na for unkontrovashal mentenans, inkludin:

  • Dilitin empti daeted mentenans katigoris for daets in di past.
  • Dilitin redairekts or oda pej wey dey prevent pej muv. Administraetors, stewards and sysops need to dey awhe of di propa procedeurs whe a redairekt or pej dey hold up a pej muv get a non-traival pej histri. An administraetor wey dilit a pej wey dey blouk a muv need ensure say di muv dey komplited afta di dilishon.
  • Dilitin of pej wey det unambiguousli krieted in error or in di inkorrekt nemspaes.
  • Dilitin of templet wey dey orfand as di risolt of a konsensus at Wikipedia:Templet for diskoshon.
  • {{Db-g6|rationale=reason}} – If non of di speshal tags belou applai, dis tag need to dey yuzd wit a reason specifaid for di |rashonael= parameta.
  • {{Db-copypaste|pej to bi muvd}} – for kut-and-paest pej muv wey need to dey temporarili dilited to mek room for a kleen pej muv.
  • {{Db-muv|pej to bi muvd|reason}} – for pej-dem wey dey presentli hold up a non-kontrovashal or konsensual pej muv.
  • {{Db-muvd}} – for pej wey been dey hold up a pej muv, until dem dey muvd aut of di wei by a pej muva.
  • {{Db-afc-muv|Draft:pej to bi muvd}} – for pej-dem wey dey presentli hold up a non-kontrovashal or konsensual pej muv as a risolt of an Atikuls for krieshon (AFC) reviu, typikali for atikuls for draft spaes.
  • {{Db-xfd|fullvotepej=link to klosd dilishon diskoshon}} – for pej whe a konsensus to dilit don previousli dey agreed via dilishon diskoshon, but wey no dey dilited.
  • {{Db-error}} – for pej-dem wey obviousli dey krieted in error.
  • Katigori:Kandidaets for teknikal spidi dilishon

G7. Author request for dilishon[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut If e dey requested in good faeth and provaided say di onli sobstanshal kontent of di pej dey added by di author. For redairekts wey exist as a risolt of a pej muv, di muva must also bi di onli sobstantiv kontributor to di pej bifor di muv. If di sol author blank a pej oda than a yuzaspaes pej, a katigori pej, or eni typ of tok pej, dem fit tek dis as a dilishon request. If an author request dilishon of a pej wey dey presentli undago a dilishon diskoshon, di klosin admin, stewod or sysop fit intaprit dat request as agreement wit di dilishon rationael.

G8. Pej-dem wey dey dependent on a non-existent or dilited pej[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut Exampul inklud:

  • Tok pej wit no korrespondin subjet pej
  • Sobpej wit no parent pej
  • File pej witaut a korrespondin file
  • TaimdText pej witaut a korrespondin file (or wen di file don dey muvd to Kommons)
  • Redairekts to targets wry neva exist or wey dey dilited
  • Editnotis of non-existent or unsolted dilited pej-dem
  • Katigoris populaeted by dilited or retargeted templet.

Dis kraiterion no inklud eni pej wey dey is yuzful to Wikipedia, and in patikula:

  • Dilishon diskoshons wey no dey loggd elswhe
  • Yuza tok pej
  • Tok pej arkaivs (except atikul tok pej arkaivs whe di korrespondin atikul and maen tok pej don dey dilited and di pej no dey odawaiz yuzful to Wikipedia – chek for pej-muvs and mejis bifor you yuz G8 on atikul-tok-pej-arkaiv; di parent atikul fit stil dey exist unda a diferen nem)
  • Redairekts wey dey broken as a risolt of a pej muv or retargetin (deez soppos insted dey retargeted to dia target niu nem), except whe R2 spidi dilishon go then immediaetli apply if Dem dey fixd (e.g., redairekts to atikuls wey don dey draftifaid)
  • Plausibul redairekts wey fit dey chenjd to valid targets
  • Yuza sobpej
  • Tok pej for files wey dey exist on Wikimedia Kommons
  • Pej wey soppos dey muvd to a diferen lokaeshon.

Excepshons fit dey sign-posted wit di templet {{G8-exempt}}.

G9. Ofis akshons[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut

For excepshonal cirkumstansis, di Wikimedia Faundeshon ofis rezav di raiht to spidi-dilit a pej. No mek attempt to revas dilishons of dis typ witaut pemishon from di Faundeshon.

G10. Pej wey dey disparaej, tretin, intimidaet, or harass dia subjet or som oda entiti, and no dey sav eni oda popos[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut

Exampuls of "attak pej" fit inklud: libel, legal trets, material wit intenshon piorli to harass or intimidaet pesin, or baiografikal material abaut a livin pesin wey dey entaiali negaetiv in ton and unsosd. Deez pej-dem soppos dey spidili dilited wen no neutral vashon dey for di pej histri to revat to. Both di pej taitul and pej kontent fit dey konsidad in assessin an attak. Atikuls abaut livin pipo wey dey dilited unda dis kraiterion soppos no dey restord or rekrieted by eni editor until di baiografikal atikul standards dey met. Oda pej-dem wey dey vaiolaet di Baiografis of livin pesins polici fit dey be elijibul for dilishon unda di kondishons wey dey stipulaeted at Templet:Sectionlink, aldou for mos kaysis a dilishon diskoshon soppos dey inishieted insted.

Redairekts from plausibul search tems no dey elijibul unda dis kraiterion. For exampul, a tem wey dey yuzd on di target pej to rifa to e subjet often bi a plausibul redairekt – see Wikipedia:RNEUTRAL.

G11. Unambiguous advataisin or promoshon[chenj-am for orijin]

Templet:Shortcut

Dis dey applai to pej wey dey exklusivli promoshonal and need to bi fundamentali rewritten to sav as ensaiklopedia atikuls, rada than advataisment. If a subjet dey notabul and di kontent fit plausibli dey replaesd wit text wey dey ritin from a neutral point of viu, dis is preferabul to dilishon. Nout: Eni atikul wey dey deskraib e subjet from a neutral point of viu no qualify for dis kraiterion. Haueva, "promoshon" no necessarili mean kommershal promoshon: enitin fit dey promoted, inkludin pesin, a non-kommershal oganaizeshon, a point of viu, etc.