Wetin wi gain

From Wikipedia

"Wetin Wi Gain" bi song bai Naijerian singa and songraita Viktor AD. ETIN Records reliz am on Jun 17, 2018.[1] Di song peak nomba 3 for Afrika Charts' list of di "Surprais Naijerian Hit Songs of 2018".[2] Di akompaniyin miuzik video for "Wetin Wi Gain" don garna ova 12 million vius for YouTiub.

Komposishon[chenj-am | chenj-am for orijin]

"Wetin Wi Gain" dey fokus on themes of materialisim and material suces. Viktor AD deskraib di song as "antem for hustlas" and tok say e dey bayzd on him pesinal experiens; him also karateraiz am as a konvaseshon bitwin God and himsef.[3] Akodin to di sheet miuzik wey dem poblish for yallemedia.com, "Wetin Wi Gain" dey G#major key wit a tempo of 64 beats pa minit. Di song dey folo a kord progreshon of G# - C# -D#.[4][5]

Miuzik video[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di ofishal miuzik video for "Wetin Wi Gain" dey uploaded for YouTiub on Julai 27, 2018; Adindu Kolins na im dairet am. An altanetiv video, wey feachor a laiv pafomans of di song, dey relizd for YouTiub on Januari 19, 2019.[6]

Recepshon[chenj-am | chenj-am for orijin]

"Wetin Wi Gain" receiv positiv revius from miuzik kritiks. Joey Akan of Di Guardian kol am an "aspiraeshonal song" and tok say e dey represent "di Naijerian drim".[7] Ehis Ohunyon of Pulz Naija komend Viktor AD for "naraetin di daili fears of di averaij Naijerian" and praiz di song for "weavin e wei enta kulchoral sentiments witaut pasin eni judjment".[8]

Accolades[chenj-am | chenj-am for orijin]

Year Awods ceremoni Awod deskripshon(s) Risolts Ref
2018 Saundciti MVP Awods Festival Listinas chois Nominated [9]
2018 Saut Saut Miuzik Awods (SSMA) Bes Pop singul; Bes niu akt Templet:Win [10]
2019 Di Headis Song of di Year; Bes Pop Singul Nominated [11]

Trak listin[chenj-am | chenj-am for orijin]

CD singul and dijital dawnload

  1. "Wetin Wi Gain" – 3:35

Oda vashons

  • Rap vashon – 3:53
  • Official extended laiv seshon – 5:15

Referens[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Marcus Brown (June 15, 2018). "Viktor AD – "Wetin You Gain"". TooXclusive. Retrieved 03 February 2024. {{cite web}}: Check date values in: |accessdate= (help)
  2. "SURPRISE NAIJERIAN HIT SONGS OF 2018". Retrieved February 3, 2024.
  3. "Wetin Wi Gain' bi a Motivaeshon to Hustlas No bi Robbas – Viktor AD". Retrieved February 3, 2024.
  4. Viktor, Adere. "KORDS: Viktor Ad – Wetin Wi Gain Kord Progreshon and Solfa Nouts for Piano, Guita, Sax, Vaiolin & Bass". yallemedia.com. Retrieved February 3, 2024.
  5. Victor, Adere. "Victor AD Wetin We Gain". tunebat.com. Retrieved March 5, 2020.
  6. "Viktor AD | Wetin Wi Gain Laiv Seshon". YouTube. January 19, 2019. Retrieved Februari 3, 2024. {{cite web}}: Check date values in: |access-date= (help)
  7. "Di Naijerian Drim: "Wetin Wi Gain?"". The Guardian. Oktoba 26, 2018. Retrieved Februari 3, 2024. {{cite web}}: Check date values in: |access-date= and |date= (help)
  8. "Viktor AD's 'Wetin Wi Gain' bi di theme song for di averaij Naijerian yout". Pulse NG. October 31, 2018. Retrieved February 3, 2024.
  9. Ehis Ohunyon (January 6, 2019). "SaundCiti MVP Awods Festival 2018: Burna wins big, Teni bi Bes Niu Artist for tod edishon". Pulse Nigeria. Retrieved 10 October 2023.
  10. Sesan Adeniji (December 3, 2018). "Di Saut Saut Miuzik Awods (SSMA 2018) Liv Up To e Bilin". MyStreetz Nigeria. Retrieved 10 October 2023.
  11. Gbenga Bada (October 20, 2019). "Headis 2019: Si aul di winas for di 13th edishon of miuzik awod for hie". Pulz Naijeria. Retrieved 20 October 2019.