Water in Africa

From Wikipedia

Wota in Afrika na big topik bikos e konsain wie di wota dey kom from, how di wota de rish pipul an how Afrika pioul dey gain for di wota.if we divide all di fresh wota-dem wey de dis wold, Afrika kontinet get onli 9% (pacent) of all di fresh wota wey de di hol wold. If we divide all di pipul-dem wey de dis wold, Afrika kontinet get onli 16% (pacent) of di pipul-dem. Some of di riva-dem wey de Afrika kontinet bi:

Na lake Victoria pipul biliv sey bi di sekod lake wey big pass for di wold. Na Afrika kontinet kari nomba two posishon for di kontinet wey wota no tu de. Million of Afrika populashon stil no get plenti wota to drink evri year.

Di risin wey mek wota no de for meni pipul for Afrika bi: Som ples get plenti wota an oda ples no get, Afrika too ova bon an populashon don ova plenti an di nomba three risin bi sey, Afrika pipul no sabi manej how to mek am posibu mek wota rish evribodi. In some pat of Afrika, some aria get plenti wota but na smol pipul dey stey for di aria. For ezampul, 30% of wota wey dey Afrika kom from Congo Basin an na onli 10% of Afrika populashon dey stey dat aria. Anoda risin wey mek wota no rish evribodi for Afrika bi sey; Rain no dey fall di sem way for difren time in Afrika. In some part of Afrika, wota tu dey dry for graund kwik-kwik an dis one dey mek di pipul no get plenty wota wen dey nid if rain no fall on time. Some pat of Afrika wey pipul dey kol sub-Saharan Africa dey si shege to get wota an dis one dey hafet bizness an how pipul go fit live for dat aria. Many Agrikolsho bizness in Afrika dipen sey mek rain fall bifor bizness for fit de ok bikos na online 10% ( picent) of Afrika land dey fit find wota for wit out rain if dey wan yuz am farm. Afrika kotinet dey sofa for di klimet chenj palava no bi smol. In mani pat ot Afrika, na wota dem dey Tek get eletrisiti. For ezampul, na Kanji Dam dey giv di big big siti wey de Naija eletrisiti. Kanji Dam still dey give some kontri wey near Naija like Niger eletrisiti too. Bikos of dis one, meni pipul don do dia best to sopot mek suo sey di wota fit dey bring eletisiti.

Even as pipul an govamet dey try mek wota in Afrika fit provide fud an eletisiti, dis tin dey hard more more bikos of sey Afrika no get beta instrumet, Afrika neva too divelop to mit di shalenj as populashon for Afrika jos di big more more. For di hol wold, na Afrika kontinet get di problem of mek pipul dey komot for vilej dey pat diasef for siti pass. Anoda shalenj wey dey mek Afrika pipul to fit manej dia riva an lake bi sey dos wota dey enta diasef.

Orijin of Afrika wota[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Wota wey de inside ground

One of di way to get wota for Afrika pipul na to dig di one wey de ground. To tok fact, na ground wota dey kip meni afrika pipul alive bikos ground wota de meni ples for Afrika, di ground wota de gud to yuz, an e dey konstat even if weyda no too gud or rain no kwik fall. Even sey ground wota de, Afrika pipul no dey tu get klin wota to drink. One risach wey dey du for 2007 tok sey ova 40% (picent) dey yuz ground wota as dia onli way to get wota espeshiali for pipul wey de North an Souta Afrika kontri. For siti in Afrika, na abaut 39% of pipul dey yuz pipe wota, but borehole don dey de popula now bikos na 24% of pipul dey yuz borehole to get wota now.

WHO (2006) tok sey, in 2014, onli 16% of di pipul in sub-Saharan Africa get wota wey tap (di tap fit dey inside house or outside house) drink an yuz. Even for dis pipul sef, di wota fit no dey klin to drink bikos kontaminrshon fit de. Some of di tin wey dey korse kontamineshon bi sey; no moni to mantain di tap, di envaromet fit don hafetdi wota.

For aria wey well de ( or konga), no bodi dey yuz enitin to testdi wota weyda e dey gud or not an meni of dos pipul wey dey drink di well no go skul to ondastand wetin bi testin of wota.

  • Wota wey de inside riva, lagoon, lake

one hoganasashon kol WHO in 2015 ripot sey e rish 159 million dey kolet wota wey den neva trit for lake, pond, riva, an stream for di wold. For Afrika, all dos big big riva dem no tu klin bikos of shit, petiro wey don enta di wota, kompini wey dia kemika to find way enta di wota. For ezampul, in Niger Delta wey bi one aria in Naija wey plenti orye kompini de, di wota for dat aria no gud at all bikos di orye don kontaminet am.