Water Supply and sanitation in Nigeria

From Wikipedia
Water Supply and sanitation in Nigeria
Country of originNaija Chenj-am

Na three levul of govamet dey kontro how pipul dey get wota for Naija. Dem bi:

Fediral govamet dey kontro all di ples wey wota fit kom out. Stet govamet dey kontro how pipul wey dey stay siti for fit get wota wey dey nid. Lokal govamet dey kontro how pipul for vilej go tek get wota. For Naija, pipul no sabi di one of di three govamet wey dey in kontro sey mek di wota de klin. In Naija, di kwuliti of wota wey wota korporashon dey give pipul o too gud an di moni wey di korporashon dey risiv bak from it de smol. Even sef di moni wey pipul sopos to pay for getin wota smol, pipul stil no dey pay di moni. Na onli wey assistans wey di korporashon dey get dey mek dem kontiniu bizness.

Nashonal polisi in Naija gri mek kompini an enibodi fit join for bi bizness of wota biziness in Naija.

How Naija pipul fit get wota[chenj-am | chenj-am for orijin]

For araund 2015 in Naija, 67 pacent of pipul wey de di kontro fit get di wota wey dey nid. For siti, na 82 pacent of pipul fit get wota wey dey nid an for vilej di nomba na 54 pacent. Meni pipul in Naija no get klin wota espesiali di pipul wey dey stay for vilej. For wetin di global wota saniteshon an hijenik statistics show, 79 pacent of Naija pipul dey find am hard to get wota. In 2015, na abaut 60 million Naija pipul no fit wota to yuz. For wota wey klin, na onli 33 pacent of Naija pipul get wota wey klin. For Siti-dem na abaut 39 pacent an for vilej-dem na abaut 27 pacent. In Naija as hol, e go rish 122 million pipul wey no get wota wey klin.