Water Scarcity in Africa

From Wikipedia
Water Scarcity in Africa
Facet ofwater scarcity Chenj-am

Wota skasiti na di wey wota no de to fit mit di way pipul nid wota. Wota go soon hard to get in Afrika by di year 2025. By dis year, if we divadi di populashon of di wold into threr pat, two pat go sofa to see fresh wota. Na dis folorin tins dey mek am hard to get wota in Afrika:

  • Afrika pipul don dey ova plenti
  • Afrika kontinet no tu get moni to tekia of dia wota
  • Klimet Chenj dey hafet Afrika kontinet.

Even sey sub-Saharan Africa dey get plenti rain, di rain get sisin an som time di rain no get patikula time wen e dey fall. Sometime, rain go fall sotey wota go full evriwie an sometime rain no go fall at all. Bikos of povati wahala, di way Afrika populashon dey plenti an how plenti pipul dey komot from vilej go dey stey for siti,dis one don mek sub-Saharan Africa as di kontinet wey poor pass an wey no divelop at all for di wold.

Di 2012 ripot wey Fud an Agrikolsho Hoganiseshon give mek am show sey e go hard dem to fit kari dia plan wey dey get to pipul bikos of how to get wota dey hard more more. Dis one na bikos sey agrikolsho an oda tins wey pipul dey du don mek wota for riva dry wel wel. Di one wey wota dey hard to get for Afrika don dey hafet meni tins. For ezampul, e don dey hafet pipul health ( espeshali wuman-dem an smol pikin-dem),e don dey hafet pipul edukeshon, e dey hafet pipul farm product, e go soon mek some kontri dey fight bikos of wota.

To rili fit mek wota no hard to get in Afrika, di [[