Wahab Dosunmu
Wahab Dosunmu (wey dem bon for 14 May 1939 and e kpai for 9 June 2013) na Naija politishan wey bi minista wey dey kontrol road and haus mata dat time wey dem dey kol Second Nigerian Republic. E bi memba for di Nigerian Senate from yia 1999 rich yia 2003. For yia 1999, Dosunmu try to bikom Lagos state govnor, but e no win, Senator Bola Tinubu na di pesin wey win am. E leta win di sit to reprisent Lagos West for Senate onda one politikal grup wey dem dey kol Alliance for Democracy. Afta som time, e komot from dat pati join anoda politikal grup wey dem dey kol Peoples Democratic Party togeda wit som oda govment pipul.
Dosunmu stil dey do strong wok for Senate, and e bi di oga for one smol grup inside Senate wey dey luk sayens and teknoloji mata rich yia 2003. Leta again, e komot from Alliance for Democracy join Peoples Democratic Party. For di yias wey nia 1990 dem, e du strong fayit to sopot di pesin wey pipul biliv say win di 12 June 1993 big elekshon, wey bi MKO Abiola. E work as Nigeria ambasador wey represent Nigeria for Malaysia from yia 2004 rich yia 2007. Dosunmu kpai on 9 June 2013 wen e don rich 74 yias old.
Pesin wey dey fayit for politiks chenj
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dosunmu na pesin wey dey fayit for govment chenj and e bi big lida inside one grup wey dem dey kol National Democratic Coalition (NADECO). Dis politishan wey don kpai na one of di pipul wey fayit mek di 12 June 1993 elekshon wey MKO Abiola win stand gidigba tru dat NADECO grup.