Vida Chenoweth

From Wikipedia

Vida Chenoweth (Dem bon am October 18, 1928 an e kpai in December 14, 2018) na pesin wey dey stodi how difren difren kolshor dey mek muzik, wey dey stodi langwej an wey sabi bit drum wey dey yuz stik du. Pipul give am praise sey na e bi di fest pesin wey wan mek drum wey dey yuz stik du bring meni sound. Pipul tok sey na di wey Pablo Casals sabi mek one instrumet wey di nem bi Cello an di wey Andrés Segovia sabi ginta na so Chenoweth sabi [Marimba| Drum wey dey yuz stik du]]. Chenoweth stat to sing in Chicago in 1956. E join anoda pesin wey sabi bit drum Ruth Stuber pafom in di Carneigie Hall. Wen Chenoweth stil dey araund 30 year, e du one gud bye show in Oklahoma in 1962 an ritaya from bitin drum in orda to faze prishin word of God. E rid muzik an hiw to translet bible. E leta bikom mishonari in New Guinea. Na for New Guinea e stat to dey yuz e muzik nolej divelop kristan mesej wit lokal muzik. In 1985, e nem enta Oklahoma Hall of Fame an in 1994, dey put e nem for "The Percussive Arts Society Hall of Fame".

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Chenoweth famili get one muzik store in Enid, Oklahoma. Na Chenoweth sinior broda advais am mek e len di old stik drum.Na piano Chenoweth fest len to dey plai but wen e injor for hand e kom stop to len am. In 1941, one lokal tisha Sydney David tish am sime tins on now to sabi bit di stik drum. Wen Chenowwth stil dey skul, e len onda Clair Omar Musser for "Northwestern" Yunivasiti an e join for di stik drum group wwy day pafom for Shikago in 1948. Chenoweth stil len how to kompos song an rait for stik drum. Bifor Chenoweth go "Northwestern" Yunivasiti wey e kom finish e final two years of stodi na William Wood kolej e fest go.