Vernacular

From Wikipedia

Vanakula na norma evri day langwej wey komon ordinari pipo wey pipo bilif sey dem no get mouth dey tok. Some vanakula langwej de for raitin sha. Vanakula langwej de difren from Standard langwej bikos standard langwej dey more arenj, dey organize, an dey haprove by govamet. Meni pipo wey sabi spik vernakula dey do am bikos na di langwej wey dem tek bon dem bi dat.

Tori about Vanakula[chenj-am | chenj-am for orijin]

Like evri loka langwej, vanakula sef get patan wey pipo dey folo wen dem wan spik-am. Vanakula langwej get dia norma word wey go with di langwej. Dey stil get how pipo dey spik di vanakula langwej. One Amerika pesin wey dey stodi langwej, John McWhorter tok abaut som vanakula wey de Amerika south wen Amerika neva old. E tok sey one of dem na Afrika-Amerika vanakula English.

Some vanakula langwej no get eni sopot from skul or govamet wey standad langwej dey get. Eni langwej wey pipo neva divelop wel, wey dem neva sit down arenj wel wel bi vanakula langwej. Wen pipo tok sey Vanakula langwej is non-Standard, dis one no mins sey Vanakula langwej no koret, abi sey e no get value or mek sens. Wetin di min bi sey, no bi Vanakula pipo dey yuz for ples wey big big pipo wey get mouth dey spik wen dem wan diskuss mata. Nowadays, pipo wey dey stodi langwej kaunt Vanakula langwej as norma langwej. Evidens don show sey wen dey stat to tish Vanakula langwej for skul, dis one don helep pikin-dem to fit ondastand English langwej wel wel.

How di word vanakula dey kom abaut[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na James Howell fest yuz di word vanakula. E yuz am wen e rait one leta in 1688. Akordin to one dishonari, Merriam-Webster, di buk tok sey Vanakula enta English langwej in 1601. Dem kopi dis word from Latin langwej. Na vernaculus (wey min Native) Latin dey kol am. Wen Latin pipo wan stat to yuz di word, na form Vanakula from verna ( wey min slave).