Venetia Newall

From Wikipedia

Vanetia Newall (dem bon am in 1935 an e kpai in 2017) na Inglish-Amerika tradishonal tori raita an e na bifor bifor presidor of di Folklore Sosaheti an fello of di America Folklore Sosaheti.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for London in 1935 dem bon Vanetia Newall. E papa na Amerika an e mama kom from England.Dorin di Sekod Wold War, Newall stey wit e grapapa in United States.In 1953, e go rid Inglish Langwej an Litireshon for Yunivasiti of St Andrew.Newall leta get Ph.D from di yunivasiti for e wok on traditional tori.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Newall luv for tradishonal tori kom from e travul wey e dey du as e dey waka abaut Sentra Europe wit e husband.In 1960, Newall dey luk araund as e dey si di way maket wuman dey dekoret egg for maket.Newall kom stat to dey kolet an stat to dey lisin to di kostom wey dey araund di egg koleshon. E buk wey e rait abaut di egg win Amerika Folklore sosaheti Chikago Folklore prize in 1971.Di nem of di buk na "An Egg at Easter". Newall na member of British Folklore Sosaheti sins heli 1960s.E don bi dia Sekretiri from 1967 go rish 1980.Pipul no am we'll wel for di sosaheti bikos e sabi invite pipul kom di sosaheti an e no how to konvis pipul wey sabi tradishonal tori kom tok for di sosaheti. Wen e na sekretiri for British Folklore Sasaheti, e hep hoganas two big hevet: "Di Anglo-America Folklore Conference" wey dey du for Ditchley Pak in 1969 an di sekod hevet "Di Folklore Society Centenary Conference" wey dey du for Royal Holloway Kolej in 1978. Nawell bi di presidor of di Folklore Sosaheti from 1985 go rish 1987. In di 1970s, Newall bikom a risasha felo at di School of Oriental and African Studies wey de London.E leta bikom visitin professor at Yunivasiti of Kalifonia, Berkeley. Newall dey put mouth for poblikeshon wey konsain tradishonal tori from 1973 go rish 1978.Na Newall bi di jeneral Editor of "The Folklore of the British Isles series" buk wey Batsford dey poblish. For 1981, Newall form "The International Folklore Review", one jonal wey dey polish evri year for Eight years. Di jonal also hep for di divelopmet of younga tradishonal tori studet tu.

Buk wey e don du[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Newall, Venetia (1971). An egg at Easter: a folklore study; (in English). London: Routledge & K. Paul. ISBN 978-0-7100-6845-3. OCLC 204744.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)
  • Newall, Venetia (2008). Discovering the folklore of birds and beasts (in English). Oxford: Shire Publications. ISBN 978-0-85263-126-3. OCLC 671785005.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)
  • Newall, Venetia (1973). The Witch Figure: Folklore Essays Honouring Katharine M. Briggs (in English). London etc.: Routledge & Kegan Paul. OCLC 1205004464.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)
  • Newall, Venetia; Dorson, Richard M (1974). The encyclopedia of witchcraft & magic (in English). New York: A & W Visual library. ISBN 978-0-89104-031-6. OCLC 987274683.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)
  • Newall, Venetia J (1980). Folklore studies in the twentieth century (in English). Woodbridge: Brewer. OCLC 901190803.{{cite book}}: CS1 maint: unrecognized language (link)