Velekete Slave Market

From Wikipedia

Velekete Slave Market na one maket for Badagry for Lagos State. Na for 1502 dem opun am an dem giv am one juju nem wey dem dey kol Vlekete, wey bi di wuman-god for big big wota and briz. Dem yuz dis maket wel wel for dat time wey slave stil dey for Naija. Na for here som Afrika pipul dey sel slave-dem giv dem oyibo-dem wey kom from Europe, dis one kom mek dis slave maket be di slave maket wey pipul sabi pas for West Afrika.

How e tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na one man wey bi Deutch wey im nem bi Hendrik Hertog but dem dey kol am Yovo Huntokonu bi di pesin way stat dis Velekete Slave Market. E buy plenti land from di pipul-dem an e turn am to wia dem dey buy an sel tins wey di chif-dem go like. Dem dey sel tins wey oyido pipul-dem get wit wetin Afrika pipul-dem get. Dem stat to dey sel slave wel wel wen dem si say di biznes get plenti moni an bikos oyibo-dem nid pipul wey go kom dey wok for dem big big fam.

Tins wey dem dey do there[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1805, di Europe-pipu kash one man wey e nem na Scipio Vaughan wey kom from Owu Kingdom for Abeokuta for Naija an kari am go dis Vlekete slave maket for Badagry wit oda slave-dem an dem put dem for ship kari go America. Dem stil kari slave-dem from di ples dem dey kol Abia State today for Naija an kari dem kom dis Vlekete Slave maket. Dem first dey put dem for prizin wey near di slave maket. Na evri 5 days dem dey yuz sel slave-dem. Dem de yuz tins like drink, gunpowda, big-big gun-dem, brekin plet, miror, umbrela, iron tins an plenti plenti tins dem tek chenj wit slave-dem.

Pipul dey like to kom si dis ples wel wel so dat dem go rili undastand how dem tek dey sel for part of West Afrika wit;

  • di Mobee Famili house an relic muzium we dem kip di rilijon tins wey show how di famili tek join dey sel slave-dem,
  • di Gberefu Island way bi di side wey dem de pas go whete dem dey kol Point of No Return where dem dey tok se na dat kind 500,000 bois, gels, yong man and wuman-dem wey dem don kach pas dis ples.
  • one wel wey bi sey if di slave-dem drink di water dem go swear sey dem no go do gra-gra with di oyibo-dem and dem go foget where dem kom from and
  • point of No return we dem de kari di slave giv di Europe pipul-dem wey go kom kari di slave-dem enta ship.