Ursula Kemp

From Wikipedia

Ursula Kemp or Ursley Kempe wey pipul sabi as Greg (dey bon araund 1525 an e kpai in 1582) na Inglish wey dey yuz tradishonal plant an leave tekia of pipul an wuman wey wan bon. Pipul hakuss am sey na Witch an dey yuz hang am wit rope onti e kpai in 1582. Pipul tok sey Kemp dey yuz juju bring sikness an e dey yuz juju kill e neibor.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for St. Osyth in Essex dey bon Kemp. E na native doktor wey pipul dey kol mek e kom trit pipul way sik. Pipul leta hakuss am sey na e dey mek pipul sik an sey eddy yuz juju kil pipul. Dey hakuss am of witch an dey joj e kase in Chelmsford for February 1582. For e kase, meni of Kemp neibor tok sey Kemp an witch an dey sopot wetin Justice Brian Darcy too tok.

Wetin happun for e kase[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kemp neibor an forma frend Grace Thurlow tok for kot sey wen e pikin Davy sik, e kari go mit Kemp mek e hep am. E pikin wel afta Kemp hep am. Sometimes leta, Grace tok sey e kom get smol kanta wit Kemp ova di tritmet of e gel pikin Joan. Afta some month, Grace tok sey Joan fall from bed an yuz neck break an kpai. Grace stil tok sey wen e no fit waka wel wel, e go mit Kemp to trit am an Kemp hagri to trit am if e bring 12 pence. Wen Kemp stat to trit Grace, Grace get beta but Grace no gri to pay Kemp di 12 pence again. Grace tok sey e no get 12 pence to pay. Kemp vex an tok sey e go ponish Grace for wetin Grace du am. Grace tok sey Afta dat fight wit Kemp, Grace tok sey e no fit waka again. Grace stil tok sey sins den, e or e gel pikin dey always sik. Grace tok sey na Kemp dey witch am dat is di risin for e sikness, e pikin sikness an di kpai wey e pikin kpai.