Uche Ekwunife

From Wikipedia

Uche Lilian Ekwunife (dem bon ha fo Ogudebe family fo January 12, 1970), na Nigerian politishian, and member of the 9th Nigerian Senate wey represent pipu of Anambra Central Senatorial District of Anambra State, an dem sabi her as one of di most active woman senator fo di Haus.

Hau shi stat laif an edukashun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ekwunife fo December 12, 1970 fo Igbo-Ukwu, Anambra to Emmanuel and Lucy Ogudebe. Ekwunife attend University of Calabar and graduate with bachelor degree in Business and Accounting fo 1993.Shi still get MBA degree from Nnamdi Azikiwe University in 2002. Ekwunife don wok fo bank an dem promote ha to area manager.

Politikal wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ekwunife don kontest fo Anambra governorship election two taim but shi no win. Dem elekt Ekwunife fo 2007 to represent Anambra's Anaocha/Njikoka/Dunukofia constituency. Shi bi one of 11 women wey dem elekt fo 2007, wey dem still re-elekt fo 2011 wen di lower haus almost bi 95% men.Oda women wey dem elekt na Juliet Akano, Mulikat Adeola-Akande, Abike Dabiri, Nkiru Onyeagocha, Nnena Elendu-Ukeje, Olajumoke Okoya-Thomas, Beni Lar, Khadija Bukar Abba-Ibrahim, Elizabeth Ogbaga and Peace Uzoamaka Nnaji. Fo 2015, dem elekt ha to Nigerian Senate. Shi bi one of the six women wey den elekt to the 8th Nashonal Assembly. The orda women na Rose Okoji Oko, Stella Oduah, Fatimat Raji Rasaki, Oluremi Tinubu and Binta Garba. Na as Ekwunife move from one politikal Pati to another one na im shi tek win. Bicos dem chalenj di elektshon fo Dizemba 2015 dem kom declare ha seat vacant. As Ekwunife no get di suppot of former politikal party (The All Progressives Grand Alliance) fo di bye-elekshon , na Victor Umeh dem kom elect as Senator. Shi win di 2019 Anambra State senatorial elekshon under the platform of di People's Democratic Party wey represent Anambra central Senatorial District, Nigeria.