Tunde Oladimeji

From Wikipedia

Tunde Oladimeji na Naijá dokumentri fim maka, aktor, dareto an televishon presenta, Dem no am as di pesin wey fest du dokumentri fim for Naijá langwej. E bi di dareto for Ajirebi wey dey sho for Africa magic Yoruba.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for Iseyin inside Oyo Stet in Naijá.E mama na tisha an e papa na sorviyo. Tunde stat to dey mek fim wen e stil dey Univasiti of Ibadan. E don join hand put Oladeju Okedidji’s 1972 buk wey dem dey kol "Agbalagba Okan".

Tunde bi di produsa for Amstel Malta Box Office Season 5.

E bi di produsa "Yoruba Heritage Documentary Series" wey dem nominate for di best dokumentri katigori for 2020 "Africa Magic Viewers' Choice Aword"

E kari bodi sho for Borokini, a Yoruba Telenovela.Tunde plai oga kpatakpata rol for inside Akekaka, di fim wey Weymouth Jaiye Kuti produs.