Toyin Adegbola

From Wikipedia

Toyin Adegbola wey pipu no as Toyin Asewo to re Mecca (dem bon am for December 28, 1961), na Naija wuman wey dey do fim,write fim and dey make fim.

How e take start fim[chenj-am | chenj-am for orijin]

Toyin start to dey akt fim in 1984 for pipu wey dey do yoruba fim under Nollywood.Shi dey among di people wey dey manage and control Osun State Art and Culture Council.Toyin really Popula for Nollywood.

Tori about im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Toyin bi di wife of one News man Mr.Anthony Kolawole Adegbola wey later die leave ha.Toyin met e husband wen she still dey work for television house, Ibadan.Dat time Mr.Adegbola dey work for NTA for Lagos.Toyin get two pikin,one girl and one boy and the two dey live for one place call Dublin wey de Ireland.Toyin na grandmama because e children don born two pikin.For Saturday 5,2016, dey make Toyin Yeye Meso of Oke-Irun,state of Osun and na His Royal Majesty Alayeluwe Oba Isaac Adetoyi Adetuluese Olokose II give am the position.

Some film wey she don do[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Asewo to re mecca (1992)
  • Ayitale(2013)