Tompolo

From Wikipedia
Tompolo
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wen dem bon am1969 Chenj-am
Ples wey dem bon amWarri Chenj-am

Government Oweizide Ekpemupolo (dey bon am 12 April 1971) wey pipo no wel wel as Tompolo na forma Naija pesin wey dey fight govamet bikos e wan chenj for Naija Delta. Na Tompolo bi di forma komanda of di Muvmet for di Emasipashon of di Naija Delta. Na Tompolo stil bi di head priest for Egbesu god, di Naija Delta god of war. NNPC give Tompolo wan bizness kontract of 40 billion naira. Di kontact bi sey mek e arenj pipo wey go dey luk orye pipeline so dat boys no go tampa wit am. Na two time, 2015 an 2019 presidet Muhammadu Buhari rejim wan harest am bikos of how e tek yuz di moni.

How e tek start life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 1971 dey bon Tompolo into di roya famili wey de Okerenkoko. Okerenkoko de Gbaramatu Kindom, Warri South Lokal Govamet aria of Delta Stet.

How e tek go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tompolo do e pamari skul for Okepopo Pamari Skul in Warri.

How govamet tek free am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen Tompolo bi di oga of MEND, e wahala govamet so tey dey tel am sey if e stop to dey fight dem, dem no go kach am put am for prisin. Tompolo kom gree for wetin govamet tok an govamet kom liv am an e boys dem. Dis tin hapun onda Umaru Musa Yar'Adua time as presidor on June 27, 2009. An na October 4, 2009 Tompolo gree to stop di fight so dat wahala no go dey hapun for Delta Stet. Dis one give govamet shans to fit do wetin dey get for mind to do for di pipo.

Di orda to go kach am[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 2016, forma presidor Muhammadu Buhari tok sey dey wan harest am bikos of sey e dey tiff an sey e dey do magomago with moni. Bifor Buhari tok dis one in 2016, pipo no see am Tompolo sins 2014 an dem no no wie e dey. Na onti 2020 pipo kom see am inside Egbesu shrine. For August 2022, Muhammadu Buhari kom ri-sahin di kontact with Tompolo so dat wahala no go de for kompini wey dey wok with orye for Delta.