Tolulope Arotile

From Wikipedia

Tolulope Arotile, (dem bon am for Disemba 13, 1995 and shi kpai for July 14, 2020),[1] wey pipo sabi as Tolulope Oluwatoyin Sarah Arotile, na di lait Naija fest wuman faita helikopta pilot for di Naija Air Force.[2] Dem sabi am as persin wey fait against insekuriti for di northern stets of Naija.[2] For 29 July 2020, Isaiah Ogedegbe prez Arotile for im tribot and e kol am "a young, brilliant, and brave lady wit a promising future".[3]

Birth, edukeshon and kariha[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Mr and Mrs Akintunde Arotile bin bon Tolulope Arotile for Kaduna, Naija for 13 Disemba 1995, but shi kom fom di Iffe area for Ijumu Lokal Gofment Area of Kogi Stet, Naija.[1]

Shi bin atend Air Force Primari Skul, Kaduna fom 2000 rish 2005 and Air Force Sekondari Skul, Kaduna fom 2006 rish 2011 bifor shi leta gain admishon into di Naija Difens Akademi, Kaduna as a memba of 64 Regula Kos for 22 Septemba 2012, wie shi get Bashilor digre for Matimatis.[1]


Arotile bin tok say shi join di militari bicos of ha luv for di militari. Shi also bin tok say to bi a militari ofisa na ha long taim drim.[1]

Dem komishon am into di Naija Airforce for 16 Septemba 2017 as a memba of di Naija Difens Akademi Regula Kos 64.[1]

Shi bin hold a komesha pilot license and also patek for tactika flying training for di Agusta 109 Pawa Atak Helikopta for Itali.[1]

For Oktoba 2019, di Naija Air Force bin dekoret am as di fest wuman pilot wey di service go get in 55 years.[1]

Dai and beriha[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 14 July 2020, les dan eight months since ha dekoreshon,[1] Tolulope Arotile kpai at di age of 24 for Kaduna, Naija.[1][2][3] Di Naija Presido, di NAF, and di Naija pipo bin show konsan abaut ha dai and di cos of ha dai na bicos shi injor for ha head wen one moto jam ha.[1][2][3]

Dem beri ha for 23 July 2020.[3] Dem rimemba am as a gud wuman wey for impact di laif of meni young Naija gels and wumen for di future.[3]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. 1.00 1.01 1.02 1.03 1.04 1.05 1.06 1.07 1.08 1.09 Arotiba, Annette; Abubakar, Mansur (15 July 2020). "Tolulope Arotile biography and di rise of Nigerian Airforce first female combat helicopter pilot". BBC News Pidgin. Archived from the original on 14 August 2021. Retrieved 1 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. 2.0 2.1 2.2 2.3 Adebayo, Bukola (15 July 2020). "Nigeria's first female combat helicopter pilot killed in a freak car accident". Cable News Network. Archived from the original on 6 October 2022. Retrieved 1 March 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. 3.0 3.1 3.2 3.3 3.4 Ogedegbe, Isaiah (29 July 2020). "Tolulope Arotile: Tribute To Nigeria's First Female Combat Helicopter Pilot -By Isaiah Ogedegbe". Opinion Nigeria. Retrieved 1 March 2023.