Tobi Amusan

From Wikipedia

Oluwatobilola Ayomide "Tobi" Amusan(bon 23 April 1997) na naija field an Trak athletes wey Sabi ron 100 mitas race an also komplit as a sprinta. Na shi win 2022 world athletics shampionship for 200 mitas hurdles, Shi set new world rekod of 12.12 sekons for semifinal, Shi kon leta du 12.06 sekons for final wey kon mek am win gold medal. Shi bi di 2018 commonwealth an 2018 afrika shampion an also two-time Afrika gems shampion for di event. Shi win di "Diamond League" Trofi in Zurich for 2021 in Di 2021 100 mitas hurdles.

Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for smol Amusan Don dey ron. Shi win silver Medal for 2013 Afrika youth shampionship in warri. Shi also win a gold medal in di 100 metas hurdles for 2015 Afrika Junior Athletes Shampionship in Addis Ababa. For 2015, wen shi dey mek ha all Afrika gems debut wen shi bi 18 years old, Shi win di gold medal for 100 metas hurdles.