Tobi Adegboyega

From Wikipedia

Tobi Adegboyega na one Naija pastor wey dem bon for 11 November 1980. Na im bi di lida and oga kpatakpata of Salvation Proclaimers Anointed Church (SPAC Nation, wey bi one of di Peticosta churches for London, England. Im na Yoruba man.

How Him take Start Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tobi Adegboyega bin move to London from Lagos, Nigeria for 2005. Wen him arrive London, him bin share one room with him cousin,John Boyega wey be actor.

Career[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pastor Tobi Adegboyega bin start SPAC Nation for Croydon inside South London for 2008 with three members. As Pastor, him dey reason with criminals to drop their weapons for the altar of him church when dem dey do service and na this kind thing make some people praise am and also come make some people take bad eye look am. For May 20 2020, Tobi Adegboyega bin step down as the Oga kpatakpata Pastor of SPAC Nation come hand over to Samuel Akokhia.

Kasala[chenj-am | chenj-am for orijin]

One BBC Panorama investigation bin torchlight Adegboyega plus other leaders of the church sake of say dem dey take cunny cunny collect money from people wey dey come the church. Some members wey panorama interview bin talk say make dem torchlight the church and Adegboyega well well as him hand no clean on top this matter. Panorama come later release one video of Adegboyega where him bin talk say him no see anything wey wrong if church members dey drop at least £1,000 every month for the church sake of say him self dey target £1 million monthly.

For January 2020, MP Steve Reed wey dey represent Croydon North bin accuse SPAC Nation of 419 plus including obtaining money by trick but sha o,police no gree open criminal investigation on top the matter.

Many many other 419, jaguda issue come join domestic abuse plus include sexual abuse na him dem don take accuse him church, SPAC Nation and him pastors.

Pesona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Tobi Adegboyega be cousin to Oyinbo actor John Boyega. Him dey live inside one £2.5 million mansion for Surrey inside England. For one interview in 2002, him talk say him don marry for 8 years.