Timini Egbuson

From Wikipedia

Timini Egbuson na Naijá akto.

Tori of e laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Bayelsa Stet dem bon Timini an e bi smol broda to aktres Dakore Akande.Timini go pramari skul for Greenspring Montessori, DI Afro School an St Catherine's.E leta go Adebayo Mokuolu College, Legos. Timini rid Psychology for University of Lagos an finish for 2011.E stat to dey akt for 2010 for M-net's soap opera Tinsel. For 2020 AMVCA awods, Timibi win di Best Aktor in a drama for wetin e akt for di fim Elevator baby. For April 2020, Timini an som aktor laik Jemima Osunde, Nick Mutuma an Lerato Walaza wit meni oda akto-dem fom Kenya, South Afrika, Naijá an Ivory Coast kom togeda to du kampain to stop di spred of COVID-19. Dem kom togeda to du 60 shot shot fim-dem for MTV Shuga, to mek pipu no abaut COVID-19 an stop di spred of COVID-19.


Fim dem wey e don akt[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • MTV Shuga
  • Fifty
  • Manhunting with Mum
  • Isoken
  • Something Wicked
  • Another Time
  • Room 420
  • Ajuwaya
  • The Missing Piece
  • The Intern
  • Elevator Baby
  • The Girl Code
  • Breaded Life
  • Dwindle
  • Juju Stories

TV sho wey e dey insaid[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Skinny Girl in Transit
  • Tinsel
  • Fifty the series
  • The Smart Money Woman