Thurderstone

From Wikipedia

Thurderstone na one hodin days stone or bone of living tins wey pipo bilif sey e dey protet pesin or buidin from bad tins. Pipo give di stone or bone di nem thurderstone bikos dem bilif sey na wie tonda hapun dem tek see-am

European tradishon[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pipo wey kom from Albanian bilif sey "thurderstones" get supa nashoral pawa. Dey bilif sey di pawa kom from wen di light shine afta wey tonda don strike. Meni famili house get "thurderstone " wey dem dey kip as juju inside dia house. Pipo bilif sey if di stone dey inside house, beta beta tins go dey folo di pipo of di house .

Pipo also bilif sey "thurderstone" fit protet mek bad tins no hapun to hanima an wuman wey get belle.

For tradishonal time[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dorin di time wey Alexander still bi king of Greece, di Greek pipo bilif sey "thurderstone" fit protet buildin. One risach wey dem do in 1985 for Romano-Bristish aria show sey twenty-nine out of forty ezampul of "thurderstones" dey in koneshon with big house, barrak, an tempu.

For midu age time[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dorin di midu age time, meni pipo dat time bilif sey "thurderstones" na di instrumet wey dem yuz tek fight for hevun. Dem bilif sey na dis tin dem yuz drive Satan an e demon kom down to dis earth. For 11 senturi, Byzantine emperor give "Holy Roman emperor" one hevun axe an in di 12 senturi one Bishop of Rennes tok sey na "thurderstones'' bi di onli instrumet wey kom from God wey fit helep win baltu, wey fit mek ship no sink inside wota, wey fit protet pesin from tonda, an fit mek pesin no drim bad drim.