Third Mainland Bridge

From Wikipedia

Third Mainland Bridge na di longest of of di three brij wey konet Lagos Island to di mainland, di oda briji-dem wey dey Lagos na di Eko brij an Carter brij. Na di longest brij for Afrika bifor Egypt build dia brij for 1996 for Cairo wey long pas "The Third Mianland Bridge". Di briji stat fom Oworonshoki kom konet to Apapa-Oshodi expressway an Lagos-Ibadan expressway, an end for Adeniji Adele Interchange for Lagos Island. E stil konet for midu to "Herbert Macaulay Way," Yaba. Na Julius Berger Nigeria PLC build di brij. Na forma presidor Shehu Shagari stat di projet in 1980 an na forma Presidor Ibrahim Babangida komplit am in 1990; di briji longest na 11.8 km. For 2006, plenti pipul wey dey yuz di briji, tok sey di briji dey shake an dem nid to du somtin kwik-kwik. Bicos of dis one, dem stat ripiye wok for difren- difren pat of di briji for difrentl - difren time wey mek dem dey klose di briji somtime an opun am as soon as dem finish di ripiye. Na for January 2013, dem finish di ripiye wok. Som peson don tok sey crak don de dey di briji but govament don sey nothin laik dat. As dem de repair di eight lane bridge, Dem do small pent wok to mek di briji fain pas bifo. Dem paint di briji guid wit di kolor of Nigeria: green, white, green, an dem still do som general painting to giv am nu luk. Dem complete di repair wok fo di briji an re-open am fo October 30, 2012. Evri wik, Di numba of pipu wey dey yus di "Third Mainland Bridge" plenti wel-wel. Pipu from Lagos Mainland to the Island, wey bi di ogbonge plez wey pipu de do bisnes fo Legos, and pipu fo Ikeja, Agboyi-Ketu, Ikorodu, Isheri, Oworonshoki, Gbagada, Yaba, Maryland and Oshodi de yus di briji evri-evri day. Di Third Mainland Bridge impotant wel-wel fo pipu to fit muv from place to place fo legos, na im mek dem de repair am from time to time. Fo 6 July 2020, dem tok sey dem go close di Third Mainland Bridge fo six month becos dem wan do repair wok. Dem stat repair wok from Friday, July 24, 2020 to January 24, 2021 fo replacement of bearing an worn-out expansion joint.

Konstrukshun[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fo 1970, afta Nigeria civil war, di prize of crude oil stat to go up an Nigeria ekonomi kom de beta.