Theo Brown

From Wikipedia

Theo Brown ( Dem bon am 16 December 1914 an e kpai 3 February 1993). Na British pesin wey dey stodi Devon lokal tins. Na Lecturer for Exeter University, e dey tich Comparative Religion.

Hau e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Jean Marion Pryce bi di nem wey im papa an mama giv am wen dem bon am in London.im mama kpai wen shi dey bon am. Im papa wey lik tuo dey stodi, wey kon leta dey wok for British Museum - no fit dey monitor am, go out am for wia pikin wey no get mama an papa dey sta. Na Dorothy Langford Brown, of Braton Hall, Kingskerswell, Devon Kari am komot for dia to dey train am an stil Kon chenjim nem to Theodora Brown.

Brown go stodi for Westminster School of Art, na for dia Mervyn Peake an som oda pipul tich am, an na for dia shi tek ci im bes frend, Magret Matcham. Shi folo for Kenn grup of artist.

For sekond WOD war shi join Women's Royal Service but im mama tel am sey mek shi no go far fom hause, hol di time shi uze na for home defens wok. Na wen shi wan join Werns Dem tel am for birth certificate, na dat time shi tek no sey no bi im mama an papa dey tek kare - sumtin wey mek am no hapi.

Afta di war, e no hapi an onli am dey tink, shi ci W.F Jackson Knight for station café of Exeter Central Railway Station. (Hau dem tek meet dey insaid Jackson Knights life tori). E afect im life afta dem meet, na im mek am stodi lokal tins an Comparative Religion, e leta bi ticha wey dey tich di wok at Exeter University. Dem Sabi am wel as memba for skul of pipul wey dey stodi lokal tins, an e get di mind sey e go sabi di way wey lokal tins dey tek hapun wey plenti pipul neva sabi. Shi gada plenti lokal storis an wey pipul dey du tins, wey dem put for Devon an Exeter Institution, di smol buk wey shi rait an im wok wey plenti pipul no ci dey Exeter University Library. Brown kpai for Exeter City on 3 February 1993.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Selected publications

.1954 The Dartmoor Legend of Mrs. Childe. Folklore 65, 103-9.

.1958 The Black Dog. Folklore 69, 175-192.

.1961 Tales of a Dartmoor Village. Some preliminary notes on the folklore of Postbridge. West Country Folklore No. 7. St. Peter Port, Guernsey. Reprinted from Transactions of the Devonshire Association XCIII (1961) 194-227].

.1964 Living Images, Folklore 73, 25-40.

.1968 (with Stephen Dewar) Ghostly Gold and Goblin Titles. West Country Folklore No. 2. St. Peter Port, Guernsey.

.1970a Trojans in the West Country, West Country Folklore No. 4. St. Peter Port, Guernsey.

.1970b Charming in Devon. Folklore 81, 19-47.

.1975 West Country Entrances to the Underworld, in The Journey to the Other World, H.R.E. Davidson ed., Mistletoe Series No. 12. Folklore Society, London.

.1978 The Black Dog in English Folklore,' in Animals in Folklore. J.R. Porter and W.M.S. Russell, eds. Mistletoe Series No. 9. Folklore Society, London.

.1979 The Fate of the Dead: A Study in Folk Eschatology in the West Country after the Reformation. Mistletoe Series No. 12. Folklore Society, London.

.1981 The Ghost of Old Mrs Leakey, in The Folklore of Ghosts, H.R.E. Davidson and W.M.S. Russell, eds., Mistletoe Series No. 15, Folklore Society, London.

.1982 Devon Ghosts. Norwich