Terri Quaye

From Wikipedia

Terri Quaye wey pipul sabi as Theresa (dem bon am for 8 November 1940, for Bodmin, wey de for England), na oyinbo singa, pesin wey dey pley piano, pesin wey dey rait song, an Percusionist. Shi bi gel-pikin of Cab Kaye wey sinio im sista wey im nem na Caleb Quaye an shi bi haf sista of Finley Quaye.

Shi du ha fest profeshona wok for 1958, wen shi sing wit Latin jazz band wey dia oga na Ido Martin. Na Colin Purbrook, Leon Cohen, an Brian Lemon dey folo am sing for stej, shi kon leta du residency wit Frank Holder. Shi wok wit for di group wey dem dey kol ''The merrymakers'' wen shi dey for Germany as a conga pleya an singa an kon stil folo Carmel Jones, Dave Pike, an Leo Wright ple song. Wen shi go Ghana wey bi di ples wey dem bon im grand papa put wey bi singa too Caleb Quaye (1895-1922), shi get ha Ga nem:Naa-Koshie.

For 1970 shi folo Manu Dibango, Syvilla Fort, Harold Mabern, Junie Booth, Richard Davis, Billy Higgins, Archie Shepp, Dudu Pukwana, John Stevens, Trevor Watts, Dr. John, an Art "Shaki" Lewis wok.

For 1980, shi kon put oll ha bodi as edukato an ethnomusicologist for Musium of African Art, Smithsonian institution, Washington, Dc United Stet, an 1990.shi kolet masta digri for ethumusicology for 1988 fom yunivasiti of London. Shi don olso sho ha sef as pipu wey sabi tek foto of oda pipu. Maplin Art Gallery get ha wok insaid dia pamanent koleshon. Most of fi song wey Shi du for 1990s na solo/piano Vokal, an shi kon open ha own bar for London, Jazzers 1996-99. Shi don bikom pesin wey dey wok wel wel as a lay preacher insaid Unitarian church. For 1970s an 80s dem no am as pesin wey bi percussionist. Shi dey liv for South Coast of England an one of di pafomance wey shi jost wan du na 2022 Swanage Jazz festiva.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]