Tems (person wey dey sing song)

From Wikipedia

Temilade Openiyi (dem bon am for 11 June 1995), di nem wey dem take no her na Tems and shi bi Naija sings, songwriter and record producer.

Fo May 2021, dem rank Tems for nomba 1 for wan chart wey dem dey cal Billboard Next Big sound chart and dem give ha nomba 5 for another chart wey dem dey cal Billboard Emerging Artists chart. For September 2021, RCA records sain ha and dem give ha Apple Music Up Next artist of di month.

Ha life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Temilade Openiyi for June 11, 1995 for Lagos, Nigeria. Ha mama na Naija and her papa na Naija and Britiko. E no too tey afta dem born am, ha papa and mama travel go United Kingdom and dem seprate wen she bi five years. Tems and ha mama faind did way com bak Naija, dem fest stay for Ilupeju bifo dem muve go Lekki den Ajah. She go Dowen College bifo she com go do ha school for South Africa. Ha music ticha dem for skul see say she sabi and she com tich ha piano. She still dey pratice ha singing with ha broda wey sabi play guitar.

Aw e take wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

From 2018 go reach 2019: Aw she tak stat ha wok, Mr Rebel and Try me[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2018, Tems sing "Mr Rebel", song wey she rite by ha self. For 2019, she release anoda song "Try Me" wey com bicom hit song. For 2020, Dj Edu chuse am as wan of di "ten artists to watch" for dat year. Dat same year, she join wan American singa wey e name na Khalid and David do remix for wan song wey dem dey call "Know Your Worth".

From 2020 go reach naw: For Broken Ears, Essence and If Orange Was a Place[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 25 September 2020, Tems relise ha fest EP fo Broken Ears, na Tems produce am and she get anoda hit single "Damages" wey folo "Try Me", e enter numba wan for Apple Music Nigeria and number sis for Turn Table Top 50 chart, e still get ova 5 million view fo YouTube. For 2020, she sing wit Wizkid for di song wey dem dey call Essence, and e enter number 1 for BBC 1Xtra Airplay Chart and she still enta Billboard Hot 100 for di fest time since she begin sing.

For 8 November 2020, dem add ha for di Future Awards Africa: Class of 2020.

For December 2020, dem arres Tems and Omah Lay fo Uganda afta their live pafomance bicos dem no obe COVID-19 lockdown safety laws wey di Uganda Police Authority put for grand. Afta two days dem release di two of dem drop di charges.

For 2 September 2021, dem write am for big sain bod for Lagos say Drake fiture Tems for im album Certified Lover Boy. Dem two sing di song "Fountains" wey give ha second Billboard Hot 100 entry for nomba 26.

For 15 September 2021, she release ha second EP wey e name na If Orange Was a Place, na GuiltyBeatz produce am and e get wan hit song "Crazy Tings" wey enta nomba 3 for di UK Afrobeats chart, nomba 7 for di Billboard World Album chart and nomba 9 fo di HeatSeekers Album chart. E get anoda song wey dem dey call "Found" wey she sing with Brent Faiyaz for the EP, dat song enta nomba 17 fo di Hot R&B Songs chart, nomba 33 for di New Zealand hot singles chart and nomba 1 for di UK Afrobeats Chart.